Minister Of Self Defence
Egbon: I bin dey think say we still dey plan to enter one chance o, na now i con confirm say we don enter am already
Mazi: You don start to dey take parable talk like this, when you no be Jesus, abeg, na you and who enter one chance
Egbon: Mazi, na all of us together, you never hear say our Minister of Self Defence talk say make everybody bear him papa name?
Mazi: Before nko, na another person papa name you wan bear, bear your papa name make i bear my papa name now
Egbon: You bin dey think say this matter wey dey ground na joke, the Minister talk say make Naija people defend themselves
Mazi: Ehn ehn, so him too don dey try talk say make everybody dey their dey be that o
Minister Of Self Defence
Egbon: Hmmm, shey you don see the thing wey i dey talk wey you think say na Joke, him talk say Naija people no suppose run if bandits con attack dem
Mazi: E wo ooo, bandits wey carry RPG, make me wey carry cutlass go face am, kai, e don red o
Egbon: Na Minister of Self Defence we get, to con add salt put ontop our injury, Buhari no gree talk

Sowore Calls For Fresh Protest
Mazi: This country na wa oh, i even hear say dem don release the name of the people wey dem kidnap for Kagara, Niger state
Egbon: Na as you hear that one, i con hear say Gunmen go attack some people for the same Niger State o, no wonder why Sowore talk say make Naija people gather do protest
Mazi: Protest kwa, my hand no dey o, small time now, we go hear say dem kill people wey dey protest
Egbon: To protest no suppose be crime if no be say this government no like make people talk the thing wey dey their mind, the thing tire me jare, no better News
Nigeria Exits Recession
Mazi: No allow am tire you, i get one better news here
Egbon: Talk am make i hear
Mazi: I hear say Nigeria don commot for inside recession, at least that one na one better news
Egbon: Hiss, like say Naija people enjoy better life when recession no dey, any difference day if no be so so add add money everywhere
Mazi: At least we suppose try hope say life go better as we commot inside recession
Egbon: Abeg, if dem dey deceive me, i no fit still dey deceive myself, na today we don dey hope, na so so hope hope everyday, e go better e go better, na which ay e wan better?
Apostle Suleman Buys 3rd Jet
Mazi: Very soon everywhere go good, i even hear say Apostle Suleman talk something o
Egbon: Him don talk the time wey everywhere go good?
Mazi: No be that one, him talk say him buy him 3rd Jet for inside COVID-19 period, say e no even do am like say make the virus finish
Egbon: Hmmm, you see now, selfish people just full everywhere, him dey buy 3rd Jet when some church member no see food chop
Mazi: Leave the matter make God judge am
Egbon: No be say i dey judge, but if we see something, we suppose fit say something, see leave that matter jare
NAFDAC Approves COVID-19 Vaccine
Mazi: Me self no too like to dey chuk mouth put for anything wey concern Man of God o
Egbon: Na you sabi that one, no be say i dey curse am, na wetin dey my mind i take my mouth talk, dem say NAFDAC don approve COVID-19 vaccine
Mazi: That one na another better news o, but that one no con mean say make we no do the thing wey we suppose do again
Egbon: Yes o, i still dey wear my face mask, wash my hand and i no dey take social ditancing joke
Mazi: Yes o, we go see later now, make i dey go my shop
Egbon: Ok now
