Buhari And Him Dear Cows
Egbon: If i talk my mind, some people go talk say i too complain, but sha o, i no go cover my mouth when i see something wey no follow, i must to talk am
Mazi: Talk, my brother talk your own make Naija better, nobody dey try cover your mouth, but try to dey talk straight, no dey do corner corner
Egbon: Before nko, i go talk, shey you don hear say Buhari like him cows pass Naija people?
Mazi: Which kind talk be this now, i no understand wetin you dey talk o, because i no know why you go talk say Bubu like cow pass the people wey vote am as Presido
Egbon: You suppose ask me say make i explain
Mazi: Abeg explain make i hear you o, i really get interest ontop the matter
Egbon: Fine, shey you know say Bubu never go visit that school where dem kidnap over 300 students for katsina even though him dey katsina ( cut in…
Mazi: You don talk that one before and i don tell you say Bubu don send delegates go the area where the thing happen
Buhari And Him Dear Cows
Egbon: Shey you don hear say this same Buhari wey no fit go visit the place where dem kidnap students don go check him Cow?
Mazi: Cow kwa, i no believe that one o, shey him cow matter pass the lives of the students wey dem kidnap abi you just wan dey carry rumour?
Egbon: You see, the thing self shock you and you no fit defend am sake of say e no show say the Presido act like say him no dey bother
Mazi: If naa true true, the thing no suppose be o
Egbon: You see, Bubu and him dear Cow nothing fit separate dem, dem be like 5 and 6
Boko Haram Claims Responsibility For Katsina Abduction
Mazi: This matter tie wrapper o, i even read am for inside News say Boko Haram talk say naa dem Kidnap those students for Katsina
Egbon: Imagine, and small time now, Lai go talk say dem don technically defeat Boko Haram people, naa wetin him go talk ontop this one now
Mazi: You dey ask me?
Egbon: If you get the answer, bring am make i see
Mazi: How i wan get the answer to this kind question now, naa me be Lai Mohammed
Egbon: Since, e be say naa you be the Chairman against complains
Buhari Not In Charge_ Soyinka
Mazi: Abeg abeg, no talk something wey no follow o, i no be government talk talk person, naa my opinion i dey talk
Egbon: I hear you, shey you don hear the thing wey Wole Soyinka talk ontop Bubu matter
Mazi: I never hear that one o, wetin him talk
Egbon: Him talk say Bubu no dey in charge of the government for the country, say, if to say him dey in charge, him suppose don do something ontop this security wey no stand well
Mazi: Tor, this security matter no be joke true true o, even these days naa so so bad tory full inside the papers, i just hope say the federal plus the state governemnts go fit do something quick quick o
Egbon: Naa to dey keep hope alive o, even Sultan of Sokoto talk say naa all over Nigeria security get K-leg, but as you talk, make we dey hopeful, i wan dey move
Mazi: God go help us o, becaue as e be now, e look like say, water don dey pass government Garri o, no wahala sha, take care.