Mazi: This Nigerian youths don dey over do like this o, abi naa wetin remain wey dem want make government do now, why dem still dey do protests up and down.
Egbon: Sometimes, you go just open your mouth waa like goat wey wan carry bread, shey you no read abi hear for news say police still dey kill and harrass innocent Nigerians, you no hear say dem kill Jimoh Isiaq for Ogbomosho
Mazi: See Egbon abi wetin be your name again self, naa everything i fit collect from you, no be like insult o, no use me catch cruise make you no hear… (Cut in)
Egbon: Hear wetin, you wan beat me, i dey explain something to you, you dey count am as insult, anyways, awa o ba tija wa
Mazi: Wetin that one mean, Egbon watch your words this morning o
Egbon: (Laughter)… Mazi, i no abuse you, we no fit fight, i only dey tell you say, i no dey fight you, meanwhile back to the matter, the reason why youths still dey protests naa because dem no believe the order of dissolution wey the IGP give.
Mazi: Nigerians self, you people dey call say make dem End SARS, dem end am, you still dey protest up and down like say, you no hear when the IGP talk say make dem dissolve SARS across the country, you no see the video, abi you no understand wetin him talk
Egbon: (hiss…, Shey naa today dem don dey talk say dem dissolve SARS, how many time dem wan dissolve am, 2017, 2018, 2019, 2020, IGP still dey give order, who dey deceive who for this naija self.
Mazi: At least, people suppose try to believe the IGP this time around, no be everything we suppose dey suspect
Egbon: My own be say, Aluta continua, victoria Asata, no retreat no surrender, wetin Nigerians want naa say make IGP mean wetin him talk, make Bubu too back the dissolution with Executive order, if that wan no dey, protest no go stop
Mazi: Na mouth mouth sha, why you no join the protest, you go dey analyse, dey blow Grammar like standing fan, why you no protest too
Egbon: Me wey be say i no get two lives, naa only this one i get o, and i no fit allow make police kill me for my family abi you no hear as dem dey kill some protesters
Mazi: Make we wait and see the change wey IGP promise, him don talk say naa all the officers wey dey the SARS unit dem go carry go another police Commands, formations plus Units
Egbon: Ok o, shey you hear say Kano Governor, Abdulahi Ganduje don do am again, he don do bebe o
Mazi: Wetin him do again, he don pocket dollars, abi naa pounds him pocket this time around
Egbon: Him no pocket dollar, Ganduje don vex suspend him Special Adviser on Media, Salihu Yakasai wey criticise President Buhari
Mazi: Ehn ehn, this wan serious o, this Ganduje no get chill at all, him no just like make anybody wey dey work with him criticise Buhari or the Presidency
Egbon: At all, him no want rara, you remember the time wey him suspend him commissioner then wey no talk well about late Chief of Staff, Abba Kyari
Mazi: I even hear say him talk say naa Kano carry first among the States wey dey fight corruption for Nigeria, him say the anti-corruption agency for the state dey do wonders
Egbon: Oro buruku lenu eye, shey naa Ganduje suppose dey talk about fighting corruption, Ganduje wey him own hand self no clean, black kettle dey call pot black
Mazi: Abi now, me self wonder o, but i no too surprise because naa naija we dey, anything goes
Egbon: INEC don even announce say naa Rotimi Akeredolu win the election wey dem do for Ondo, dem talk say he beat Jegede, Agboola and other candidates for the state
Mazi: Me self hear the announcement, but i still con hear other rumours join
Egbon: Which rumour you hear again o, abi no be him win am, cuz i know say naa Abuja you dey during the election, you no dey Ondo
Mazi: I no dey Ondo true true, but i hear on top internet say, dem dey buy votes with 7k, 10k and even 25k for some polling units
Egbon: Nawa o, so naa wen this kind thing wan stop for this country now, abi naa like this we go dey dey ni
Mazi: This JAMB question wey you ask now, who go answer am for you, abeg me wan dey go, we go talk later ehn
Egbon: Ok o, take care o, i sha no say we go dey ok las las