Sunday Igboho Expose Ooni
Egbon: I no just understand why people no get respect for our Culture and tradition again for this country, nawa o
Mazi: My brother, na as the thing dey worry you for mind, naso e dey worry me too
Egbon: Imagine, i see one video where Sunday Igboho dey call Ooni of Ife bad bad name, him even talk say him head no correct
Sunday Igboho Expose Ooni
Mazi: Ahhh, that one no follow o, why him go talk that kind thing
Egbon: Abi now, for Yorubaland, we believe say if person dey cry, him suppose dey see, him even talk say Tinubu, Seyi Makinde wey be Oyo governor plus some Kings dey behave like Fulani slaves
Mazi: That one heavy for mouth o, make we no lie, him no suppose abuse the King, even if him dey vex for Fulani people
Egbon: For inside the video, Igboho con talk say the Ooni no fit talk true sake of say him don collect dollar from Buhari hand
Suspected Fulani Rape Lady In Akure
Mazi: Taa, me no believe that one, but wait o, wetin dem fit do to take stop the criminals wey dey among these Fulani people like this
Egbon: Mazi, naa very big question you ask me like this o, but my own na say government never dey serious
Mazi: But why you talk so?
Egbon: Because, if true true dem dey serious, government no suppose dey take mouth follow the criminals wey dey among the Fulani talk
Mazi: Ohh, so na wetin dem suppose take follow dem talk o?
Egbon: Na action go fit stop that kain thing, e no too long wey i see one video where one suspect wey dem talk say naa Fulani go rape one lady for Akure
Mazi: Chai, that one serious o, this matter no be joke again o
Egbon: E never finish o, dem talk say him even try to commot the lady eyes
Mazi: E better make government do something quick quick o, make the matter no con turn another thing
Tunde Bakare Lambast Buhari
Egbon: Because na small small something like this dey turn big matter if dem no take better hand handle am
Mazi: Con check this tory o, dem say Pastor Tunde Bakare talk say Buhari don fall Naija people hand no be small
Egbon: Him no lie now, you no see the things wey dey happen for inside the country, na change him promise, na another thing Naija people dey see
Mazi: Hmmmm, security no even suppose dey part of the thing wey government go dey take play politics
Egbon: You talk am well, before you open eye now, different different people go dey find how dem go take dey protect themselve
Mazi:And that kind thing no suppose be, if government no fit protect him people, na like that people go con dey carry weapon dey do jungle justice
DSS Raises Fresh Alert
Egbon: Abi now, i even hear say DSS don warn Naija people again say make dem no sleep ontop bicylce sake of say some people bin dey plan to cause kasala for the country
Mazi: I bin think say DSS don talk this thing before before o
Egbon: No be lie, dem don talk am before, e look like say dem don see another reason to talk am again
Mazi: That mean say if dog no see something, him no go dey bark
Egbon: Gbam, Mazi, you remember say na the other day we dey talk say some young young boys chop live chicken sake of say dem wan get money
Mazi: I remember wella, you don see another people wey chop live chicken, abi you say wan follow chop
Egbon: God forbid bad thing, naa inside News i see say dem arrest 3 guys o wey wan take one girl do ritual for Edo
Mazi: Kai, this young young people and ritual don dey look like 5 and 6 o, make God dey keep man pikin o
Egbon: The desperation wey dey town no be small, make i con dey move jare
Mazi: Ok, take care