Ibe Kachikwu In Theft Scandal
Mazi: These Taliban no dey joke for Afghanistan o, dem just dey match ground anyhow like say tomorrow no dey (cut in..
Egbon: My brother, leave Taliban for Afghanistan, make we sew our clothes for where e tear for Naija here
Mazi: If your clothes tear, carry am go give Tailor now, why you dey use your tear tear clothes stop the follow up wey i dey do ontop foreign gist
Egbon: Pele o, Omini-Foreign, no be Oyinbo talk say na from house Charity suppose start, you never hear say another before before Naija leader don go shame us outside the country
Mazi: Ohhh, na who be that before before Naija leader and how him take shame himself, because nobody fit shame me, i no follow dem chop money
Egbon: No be Ibe Kachikwu, the before before Minister of state ontop petrol matter, you remember am?
Mazi: Hmmmm, Ibe Kachikwu, the name sound like the wan wey i know but i no too remember him face
Egbon: No worry yourself, con check him picture here…. na the Ibe Kachikwu be this, wey be before before NNPC oga
Ibe Kachikwu
Sheik Gumi Berates Politicians
Mazi: Oh Oh Oh, i remember now, wetin dem talk say him do like this?
Egbon: Na one court for USA talk say dem find the car wey Ibe Kachikwu thief from UK o, say him take style carry the thing enter US, and you wan make i beleive say these politicians own no worse pass the one wey Yahoo Boys dey do
Mazi: Egbon, no be who do pass we suppose dey talk now, na to condemn the thing wey dem dey do, the thing dey tarnish Naija image no be small, Abba Kyari own still dey ground
Egbon: Imagine o, Naija image con dey dance inside mud everyday, dem even dey match am anyhow and dem expect say serious countries go respect us
Mazi: E no follow o……Bia, you hear the thing wey Sheik Gumi talk ontop how some politicians carry private jets go Buhari son wedding for Kano?
Egbon: Abeg gist me full full, i never hear the thing wey him bin talk
Mazi: Him talk say dem no try at all, say dem carry private jets go Buhari son wedding when innocent Naija people dey cry for the hands of bandits dem, say e no suppose be like that
Nairobi Announces New Law
Egbon: Well, him get point, but, las las, the thing no surprise me at all, because e show say dem no care about the thing wey dey happen to ordinary Naija people
Mazi: But, make we commot sentiments for this matter, Bubu no go cancel him son wedding sake of say some people dey for bandits hand now
Egbon: Nobody talk say make him cancel him son wedding, my own be say, him government no take action wey fit stop the thing wey the bandits dey do
Mazi: No be lie sha, but to fight this kain war dey take time sometimes
Egbon: E no suppose take forever if government serious…. I even hear say Nairobi government don pass law wey go make anybody wey blow catarrh without using handkerchief to go prison
Mazi: Shuuu, prison kwa, ontop say dem blow nose
Egbon: Yes o, dem say na to make sure say the country dey clean and hygienic
Mazi: Egbon. come check how dem find three human heads for inside this man fridge o, dem say him na footballer for Ghana
Egbon: Hmmm, wetin dey happen for this world self, evil just full everywhere like say tomorrow no dey, na make baba God dey take him protection cover us o, we go see later now
Mazi: Amen o, take care