Sunday Igboho
Mazi: Hmm, e make sense make person get better friends for this life o, Kai, see as friends and business partners support this Obi Cubana wey bury him mama for Anambra
Egbon: No be lie o my brother, plus e look like say the man na better man, plenty people dey talk say him dey support him friends too
Mazi: Na like that e suppose be now, I scratch your back, you scratch my own, no be some people wey go dey expect say make person dey rub their back everytime
Egbon: Na that kain people Oyinbo man dey call parasitic friendship
Mazi: Hmm, this your Grammar get weight o, dem say some IPOB member wan go break the Jail where dem put Nnamdi Kanu
Egbon: Where you see the news?
FG Expose Sunday Igboho
Mazi: For inside Newspaper now, the News talk say na Security people dey suspect say the IPOB people wan make government carry Kanu go another prison make dem fit attack the place free the man
Egbon: I no even know wetin to believe again for this Naija, different different talk, and this government no too dey talk true, no be so dem say Sunday Igboho bin dey plan to run commot for Naija
Mazi: But i bin think say dem don pack him passports that time wey dem go burst him house for midnight
Sowore Raises Alarm
Egbon: Me self surprise when i see the tory o, dem con talk say Igboho dey plan to go collect another passport wey him go fit use run commot for Naija
Mazi: Well, e possible make government get some information wey Naija people no get ontop FG Sunday Igboho matter
Egbon: Commot there jare, which information, how that wan take reduce the price of Garri, Rice or Beans for market, you no see as everything cost like gold
Mazi: No be fight now, we gather dey buy the thing and nobody like am like that, i just dey try talk say e possible make government know the thing wey common man no know ontop this Sunday Igboho palava
Egbon: Nobody dey fight you, my own be say, the information wey get ontop bandits, plus Boko haram, wetin dem take am do
Mazi: I no dey Buhari cabinet now, you hear say Sowore don announce say him wan do another protest throughtout the country?
Egbon: Make him no waste him time, this government no go allow make the protest happen as dem no like to dey see say people talk the thing wey dey pain dem for mind
Pastor Adeboye Extols TB Joshua
Mazi: Hmm, na when him announce say the protest go happen for August him con talk say government people don already write the result for 2023 elections
Egbon: Na Naija we dey o, anything dey possible, you no see as some lawmakers dey fight say dem no want electronic voting, dem dey fear say the thing fit cast dem
Amputee Hawker Buys 17 Million House
Mazi: I still believe say Naija people fit decide how the elections go be if dem register and come out to vote when time reach
Egbon: Gbam, I pray make people wake up o, make e no be say na after 2023 elections de go come still dey complain, dem say Pastor Adeboye do finally talk ontop TB Joshua death, say him send letter give him wife
Mazi: That wan make sense now, at least, him don pay him last respect like that, con check this tory o, dem say that Lady wey dey sale pure water for Lagos don buy 17 million naira house
Egbon: 17 million naira keh, that means say people contribute plenty money give her that time o
Mazi: Yes o, she say na 25 million naira people contribute give, she even don start to dey build pure water factory, make i con dey go jare
Egbon: Ok now, make Baba God no forget us too, make him bless our hustle
Mazi: Amen o