Father Mbaka
Egbon: You see ehn for this life, e no dey make sense if person no respect himself, because na the way you carry yourself other people go take carry you
Mazi: Elder Egbon, i sure say e get where you dey go with this your proverb, go there make i see wetin you dey try bring out
Egbon: The place where i dey go no far, na Father Mbaka house i dey go and i don reach there already
Mazi: Tor, wetin him do you again, i bin think say people don commot mouth for him matter
Egbon: This time around, na APC dey drag him because him no put himself for the position where people suppose dey give him respect
Father Mbaka
Mazi: E reach that one, wetin APC talk say him do now o?
Egbon: APC Drag Father Mbaka, talk say the thing wey him talk say make Buhari resign pass him mouth, say him no suppose talk like that as person wey be man of God wey suppose use prayer help Naija
Mazi: True true, na the way wey person carry himself other people go carry am, if to say him no too dey run after politicians, him ear no go hear this thing
Egbon: Naso APC talk am o, dem say if him no put him hand where e suppose dey say dem go open him secret, dem con advise say make him copy Pastors like Adeboye plus Kumuyi, say dem dey pray for Naija

Presidency Gives Benue Governor Condition
Mazi: Father Mbaka suppose don learn him lesson like this, con see the thing wey federal government dey tell Benue state governor, Samuel Ortom
Egbon: Abeg, gist me, wetin dem tell the Governor?
Mazi: Dem talk say the only thing wey him fit do if him want make peace reign for that state na to accept RUGA policy, wey federal government announce to allow make Fulani people fit settle down do their cow business
Egbon: Hmmm, you see now, this government go just dey do somethings wey go make people to dey suspect say dem get hidden Agenda, because i no understand how dem go dey tell a whole governor how him go take rule him state
US Speaks on Insecurity In Nigeria
Mazi: E no suppose be like that o, so the state no go get peace now if him no allow RUGA
Egbon: Na wetin dem mean be that o, no wonder why US government talk say the security challenge wey Nigeria dey face don pass ordinary, dem say na extra-ordinary case the thing be
Woman Dies During Fasting
Mazi: Na wa o, this thing don dey red o, wait fess, this tory look wan kind o, dem say this woman die inside the church where she go pray sake of say her marriage no get joy
Egbon: Ahhhh, how the thing take happen?
Mazi: Dem say na 14 days fasting and prayer she go do for the church o, say she don fast for 10 days, na the 10th day she con faint and as dem rush her go hospital, na there she pai put o
Egbon: Ehn ehn, wahala just plenty everywhere, person wey no get husband go dey pray say make she marry, some people wey con get husband still dey pray to get joy
Mazi: My brother, life no balance o, anybody wey get better marriage, suppose dey thank Baba God for him life o
Egbon: Thank God o, we go see later jare, i wan go for one meeting
Mazi: Ok now, we go see