Mazi: I hear say some people dey hail IPOB leader, Nnamdi Kanu, dey call am Prophet wey dey see the things wey never happen
Egbon: Hmmm, no be lie o, i no fit doubt that kind talk o, e look like say the man too sabi plenty things wey many Naija people no know
Mazi: E even get one Journalist wey open everything wey Isa Pantami dey try hide, naso some people con talk say Kanu don dey talk many things wey resemble am before now
Egbon: Federal government no even do like say dem hear anything ontop the matter, at least make dem even try torchlight am to see whether na true or lie
IPOB Challenge Nigerian Government
Mazi: I bin dey think say government go say make him go rest for house first, make dem fit torchlight the matter o
Egbon: Dem no talk anything, na IPOB plus MASSOB and EndSARS people dem no wan hear
Mazi: Me i still dey hope say government go do something ontop the matter
Egbon: Sunday wey go good, na Saturday we suppose don dey see sign, i no see any sign say government wan do anything ontop this Pantami matter
IPOB
Mazi: Make we wait small, e possible make dem dey torchlight the matter under Table
Egbon: Under Table kor, under chair ni, you hear the thing wey IPOB talk?
Mazi: Say dem wan commot for Naija?
Egbon: No be that one, dem don talk say make federal government announce the name of people wey dey ask for money
Mazi: Which money be that?
Egbon: you don forget say Garba Shehu talk say some people wan make federal government give dem money, say na why dem dey call say make Naija break up be that
Mazi: Ohh, i don remember
Egbon: IPOB con talk say make dem mention the name of those people wey dey ask for money, con even add say na Nigerian government dey try give Nnamdi Kanu money make him fit shut up
Tatoo Trend Reach Governor Ayade
Mazi: Na wa o, if na true say people dey ask for money, make federal government announce their name now
Egbon: Abi o
Mazi: Ahhhhh, Naija people no go sha stop to dey surprise me sha
Egbon: Surprise package full Naija, who surprise you again o?

Mazi: No be this lady wey draw Governor Ayade tatoo for her body, she talk say she too love the governor
Egbon: Governor Ayade of Cross River State?
Mazi: Yes now, e look like say the lady don dey think the person wey she go draw put for body, con conclude say na Ayade she wan use
Landlady Demands Sex Instead Of Rent
Egbon: She never learn lesson from the woman wey talk say her husband send her commot for house sake of say she draw tinubu tatoo for her body
Mazi: She go learn las las, na sake of money many of dem dey do that kind thing
Egbon: Hiss, no mind dem, Mazi, con check this tory o, but, you sure say this wan dey possible like this?
Mazi: Anything dey possible o, wetin happen
Egbon: No be one man wey talk say him landlady bin ask say make him dey do plo plo with her say she no go collect rent for Lekki
Mazi: Ehn ehn, this wan get as e sound for ear o, so she no go collect money from the man hand, she just wan make him dey service her, but wait, the man do am
Egbon: Him say him no do o, but na only God sabi the truth wey dey inside the end of the tory, make i con dey waka jare
Mazi: Laugh, this laugh sha, plenty things dey play inside this life, we go see now