Census For Sex Workers
Egbon: Nothing wey person ear no go hear for this Naija, wetin be this wan again now
Mazi: Omini seer, wetin you don see again like this?
Egbon: No be this tory wey i dey read wey talk say Bauchi state government wan do census for sex workers for the state
Mazi: Census for Ashawo, shey no be dem dem dey call sex workers again?
Egbon: You self see why the thing shock me, i no just understand the kind leader wey we get for this country sha
Sex Workers
Mazi: You don read the tory finish?
Egbon: I kuku don read am, the commissioner wey dey in charge of Hisbah for the state talk say dem wan do census for the sex workers so that government go sabi how many dem be
Mazi: Ehn, after dem con sabi how many dem be, wetin goi con happen
Egbon: Say the state government wan try find dem money wey dem fit take do small business wey go make dem get handwork
Mazi: Hmmm, and that one no be bad move o, at least, if government fit give the sex workers money to take do business, e for good o
Twitter Chooses Ghana Over Nigeria
Egbon: Hiss, which government, how much dem wan give dem, e go pass the 5k, 10k wey dem dey share before anytime wey election dey near
Mazi: You no fit conclude like that, na the state government sabi how dem wan do the thing wey no go allow make sex workers dey for the state again
Egbon: That wan na dream wey no fit come to pass, you know the amount wey those people dey see everyday, how much government wan give dem wey go do dem?
Mazi: At least e show say the state government try, wait fes, i hear say Twitter wan carry dem Headquarters wey go dey Africa put for Ghana, na true?
Egbon: The thing over true self, i hear am too and i hear say Twitter don explain why dem choose Ghana
Mazi: Why now, na Naija dem suppose carry that kind thing come now, at least na we be Giant of Africa
Egbon: Giant of Africa kor, African Giant ni, make dem carry business con the place wey no get light, make dem con take all their profits buy diesel finish, con pack the business run commot later
Mazi: But why you no dey dey positive self
Egbon: Pele o, positive fm, no be say i no dey positive, the thing be say i no dey deceive myself, to do business for this country no dey sweet people belle
Mazi: At least you fo allow make Twitter talk why dem no come Naija
Egbon: Dem don talk am, dem say na because Ghana allow freedom of speech, say dem no dey take iron hand handle dem citizen wey dey ontop social media
Mazi: Na wa o, so like this like this, Twitter don carry dem Headquaters go Ghana?
Egbon: Yes o, and i sure say plenty people go see work do through that kind move, and na so so rest our Presido dey rest up and down
Kaduna Government Sacks 4,000 Workers
Mazi: Allow make Buhari rest o, body no be firewood, con check this tory wey talk say kaduna government sack 4,000 workers
Egbon: Ahhhh, that wan na wickedness o, why the government go do that kind thing
Mazi: No be wetin you suppose ask be that
Egbon: No be him i ask so, if no be wickedness, wetin dem wan make those people dey chop as the economy squeeze face like this
Mazi: Na sake of say the economy squeeze self make the government sack dem o, the governor talk say money no too dey ground
Egbon: Ehn ehn, so, make those people go find how dem go take survive, and you sure say crime no go plenty for that state with this kind action like this?
Mazi: Say government sack dem no suppose be excuse to go dey do crime, anybody wey do crime go go jail
Domestic Violence Is Evil
Egbon: Tor, i hear your own, but some people third name na wickedness o, see this man wey kill him wife wey get belle for Lagos
Mazi: How the thing take happen
Egbon: Dem say no be today the man don dey beat the woman ontop small misunderstanding, say this time him con beat the woman plus him six month belle so tey, the woman con faint
Mazi: Chai, which kind wickedness be that one
Egbon: Na pure wickedness, him no stop there o, i hear say as the woman faint, some people rush her go hospital, the man con later go the hospital commot the oxygen wey dem dey try take wake the woman, she con Pai
Mazi: Ahhhhhh, this man wicked no be small o, abeg, make i con dey go, this wan weak me
Egbon: Him go learn well for prison, take care jare