Kanu Attacks Aliko Dangote
Egbon: I know for sure say meself go get money for this life wey i come (cut in..
Mazi: To get money no be mouth o, anybody wey wan get money go hustle well well
Egbon: No be you go tell me that one, i know say to get money no be by to dey talk or pray alone
Mazi: La yan, this wan wey be say na money matter you take welcome me, alert don enter?
Egbon: No be say alert don enter o, i just dey check this list wey Forbes announce ni jor
Mazi: Ehn ehn, wetin dey inside the list?
Egbon: Forbes say Jeff Bezos na the number 1 Billionaire worldwide, dem talk say him get $177 billionaire, dollars o, chai
Mazi: No allow your BP to dey go up o, remember say no be one day him gather the money, everything for this life na turn by turn
Egbon: I pray make e reach my turn quick o, imagine, na only Aliko Dangote be the Nigerian wey dey among the first 200 Billionaires for this world
Mazi: So, Otedola, Alakija dem no dey the list?
Egbon: Dem no dey o, even self na American plenty pass for the list
Aliko Dangote
Mazi: But, wetin Aliko Dangote dey do wey other business people no do webi say na him be the only Nigerian among 200 Billionaires
Egbon: My brother, the thing dey wonder me self o, him money no be here, according to the thing wey Forbes talk, na 11.5 Billion dollars him get
Mazi: No wonder why Nnamdi Kanu talk say na 419 aliko Dangote be
Egbon: Ahhhh, how him take be 419, the Forbes talk say na through cement , sugar plus other things wey him dey produce him take dey make him money
Mazi: Kanu no gree o, him talk say Aliko Dangote bin dey sale cement for 1,150 for Zambia, but dey sale am for around 3 to 5,000 for Nigeria
Egbon: Ohhh, na why him be 419 be that?
Mazi: You self check the thing well now, fine, no be say him no dey try support Naija economy o, but e look like say him dey scam Naija people
Egbon: Hmmmm, i remember say America government don talk one time like that say e get how aliko Dangote dey bite and dey fan Naija people, say him dey use one hand give something, dey take another hand collect am back
Mazi: And some people still dey beleive say fuel go cheap if him finish him refinery, anyways, we go see how the matter go be
The New Acting IGP
Egbon: Yes o, na eye wey get patience fit see Nose, but Mazi, e look like say all these Cabal people don resume work for Aso Rock o
Mazi: Dem get off before, but why you talk say dem don resume work
Egbon: You no see as dem take disgrace the before before Oga for ekelebe, Mohammed Adamu, commot am fiaaam
Mazi: Hmmm, e chock me o and i sure say the thing go shock am self cuz i hear say na Imo state him dey that time wey news break say Buhari don appoint new acting Oga for ekelebe, Alkali Baba
Egbon: You see why i talk say Carbal don resume work so, Buhari wey no fit commot the Oga for ekelebe when him dey Naija con commot am from UK,where him go collet treatment
Mazi: Laugh…, na everything you dey read meaning to, e no mean say carbal don resume work, las las na Osinbajo decorate the new IGP
Egbon: Forget that thing, say him decorate new IGP no mean say na Buhari appoint am, e fit be those carbal people
Man Cut Off Him GrandMama Head
Mazi: Well, the thing wey matter pass na say Naija don get new IGP, ahhh, con check this tory o, kai, people too wicked for this life
Egbon: Wetin happen again?
Mazi: Dem say one 20 year old man cut him grandmama head for kenya, con carry the head go police station for that side
Egbon: Ahhhhh, which kind thing be this, you sure say this world no go soon end like this?
Mazi: All these things wey dey happen na sign say the world don dey plan to end o, make i go make some meoney before e end sha
Egbon: Everytime, na money, money, e possible make you don find money go self the time wey the world go end
Mazi: Na your cup of tea be that o, i don go