Beware Of Cucumber
Egbon: I know say you go don hear the news so i no need ask you say shey you don hear
Mazi: Laugh, you self no say my own current naa full one, e no dey low at all
Egbon: Ohhhh, so, you wan start to dey feel yourself like that
Mazi: Naa person wey get body suppose raise shoulder o, anyways naa which news you dey talk
Egbon: Pele o shoulder raiser, Naa the one wey talk say Bubu don sack Service Chief i dey talk
Mazi: Ah ah, na who never hear, i don hear am since and na better something say las las Bubu do the thing wey Naija people wan make him do
Egbon: Abi o, but, after him sack the before before service chiefs, con appoint New ones, i con see one video o
Mazi: Na wetin happen inside the video?
Egbon: Hmmm, Mazi, for this life ehn, any position wey man dey, him suppose dey do well o, sake of say one man no fit dey power for life
Mazi: No be lie, but you never answer the question wey i ask you o, na wetin dey inside that video wey you see?
Egbon: For inside the video, naso i see plenty soldiers dey dance sake of say Bubu don sack Buratai con appoint another Oga for Nigerian Army
Mazi: Hmmm, naa na now, i dey try understand where you dey carry the matter go o (cut in…
Egbon: I no carry am go anywhere, the thing wey i dey try talk na say e dey ok make person dey do good
Beware Of Cucumber
Mazi: Na the same thing we dey talk, na you no coolu temper make i talk wetin dey my mind
Egbon: I bin dey think say you wan carry the matter enter politics ni, according to the video sha, e show say plenty soldiers no dey happy with Buratai
Mazi: Na the meaning be that now, but wait o, why dem no change Oga patapata for ekelebe dem?
Egbon: I no even too understand that one, but the way i dey look am, e be like say the time wey him go retire never reach
Mazi: Ok, i hope say these New service chiefs go do better pass the people wey dey there before before o, make Naija fit get correct security
Egbon: Me self hope so, make e no go be say na same tory we go dey hear everytime
Mazi: Egbon, you no go believe one video wey me self see ontop internet o
Egbon: Ehn ehn, e be like say naa video video something con dey reign now o, abeg wetin happen inside the video?
Mazi: Hmmm, the thing shock me no be small, i con dey wonder say why people dey wicked like that
Egbon: You don start to dey do suspense like that, wetin happen, shey i do suspense when i talk my own
Mazi: No be suspense, na as the thing take shock me still dey wonder me o
Egbon: E never reach make e shock you finish, wetin happen jare?
Mazi: E be like say you no wan make i yan you the tory again
Egbon: No yan me again self, which one be this long suspense now
Mazi: Make i yan you, na one lady like this i see for inside the video o, she talk say naa Cucumber her Mama dey sale
Egbon: Ok, naa wetin con happen to the lady abi naa the Cucumber ?
Mazi: She con confess say she dey always take that Cucumber do plo plo for her toto everynight, con return am to the one wey her mama dey sale
Egbon: Ahh, you sure say this thing true like this?
Mazi: Naa my korokoro eye i take see the video o, she say, her mama no go know wetin she don take the Cucumber do, she go con carry the thing go market go sale
Egbon: Oluwa o, naa wickedness be that o, the thing wey people go buy chop, she dey put am for her toto
Mazi: Hmmm, odikwa serious o, na why i no just dey buy things chop anyhow be that o, e better make person dey shine eyes o, make i con dey go my shop jare
Egbon: Na Baba Godey fit safe man pikin o, we go talk later