Naira Marley, The Role Model
Mazi: Naa different different tory person go dey see inside paper, we no even dey sure where this world dey go again o
Egbon: Hmmm, e look like say people no wan dey do better thing again o, naa so so bad bad thing plenty for inside the world
Mazi: Imagine o, i read am for News say some small small school pikin dey do like Naira Marley, pikin wey never sabi anything o
Egbon: O lagbara o, so among the plenty people wey dey inside this life, naa Naira Marley dem wan take do role model (read more here)
Mazi: E shock me as i see the tory o but i con take another eye look am, the thing no con shock me again
Egbon: Oshey eyan 2 face, one eye show say e good, the other eye say e bad, abeg, how e take good o
Mazi: You don start make you dey give the thing wey i talk another meaning o
Naira Marley, The Role Model
Egbon: No vex, naa as i take understand i talk am, talk am well make i fit understand
Mazi: You suppose ask if you no understand the thing wey i talk
Egbon: No be why i ask you now now say make you explain?
Mazi: Ok, for one side, i no support the thing wey the school pikin do, for another side, i bin dey think say naa because say Entertainment don get atention pass Education dey cause am
Egbon: Hmm, you talk am well, infact, you no miss any point self, you no see how much dem dey give people wey dey do entertainment
Mazi: Nawa oh, so as e be now, naa Naira Marley the school pikin wan take do their role model
Egbon: Naso we see am o, i even hear say Amotekun arrest the pikin, Naira Marley con say dem no suppose arrest dem
Mazi: Dem suppose give the pikin better home training, nobody say make dem no use their talent if dem wan use am, but no be say, we go dey support behaviour wey no follow
Egbon: Naa that one you see wey you dey talk, shey you don see the photo wey show say Desmond Eliot siddon with one Boy wey dey do like girl, like Bobrisky own
Mazi: Ahh, the same Desmond Eliot wey dey Lagos State House of Assembly?
Egbon: Yes now, dem dey call the Boy James Brown, him dey do like girl, dey wear wig, do make up
Mazi: I don talk am say, i no understand where this world dey go again
Egbon: As the Boy see say Bobrisky dey make money from the one wey him dey do, naso, him too join o
Mazi: Taa, the thing wey money go cause for this life, no be small o, con check this tory o
Egbon:Ehn Ehn, you mean say this woman sale her baby like this
Mazi: Naso me self dey shock when i read am o, dem say, she go sale the baby give one Pastor for 10, 000 naira
Egbon: 10, 000 naira keh, which kind thing be this now, how person go born pikin for him belle con still go sale am
Mazi: Dem say naa the pastor wey buy am con go report the matter give Amotekun people wey con later arrest the woman
Egbon: Kai kai, why you born am when you know say you no go fit keep am
Mazi: She talk say the Boy wey give am Belle don run go say she no sabi how she go fit care for the baby
Egbon: Nawa o, things dey happen for this life o, make i con dey go jare
Mazi: Ok, take care