MultiChoice Enter Wahala
Egbon: E just look like say everything don turn to comedy since dem talk say make dem change Naija name to UAR, i just dey see different different tory wey dey look like joke, con dey make me cry inside say wetin dey happen
Mazi: Laugh…., this your observation get as e be o, no be today we don dey see some of the tory wey we dey see for this country now
Egbon: My brother, e look like say, e don dey too much o, imagine the thing wey a whole Governor dey talk say make dem take NYSC do
Mazi: Wetin him talk say make dem take am do, and which Governor talk am?
Egbon: No be this Taraba State governor, Darius Ishaku talk say make dem make NYSC two years, say make dem take 1 year do military training, con use the rest serve
Kaduna Bandits Demand Foodstuff
Mazi: Ehn ehn, how that wan take provide solution to the thing wey dey happen for Naija
Egbon: No be why i talk say the country dey look like comedy be that, the 1 year wey dem dey do, how many people don get job
Mazi: Hmm, na that NYSC own you see wey make you dey talk, wetin you go talk if you see this tory o, dem say those bandits wey collobi students for Kaduna dey ask for foodstuffs, say dem no get food for their side again
MultiChoice Enter Wahala
Egbon: Laugh… Kai, na make Baba God no allow make this country become Banana Republic las las o, which kain dirty talk be this one again, no be so some bandits dey ask for motocycle the other day
Mazi: Na serious matter o, i just dey imagine the kain pain wey the family of those students go dey face now
Egbon: Hmmm, na as the tory dey look like say e funny one side, e still dey make person cry, innocent students wey go school jejeje o
Mazi: Government suppose do something wey fit stop this collobi of students wey don dey turn noraml something for this country like this
Egbon: Forget dem, na Twitter, Sunday Igboho and Nnamdi Kanu be their assignment wey dem wan finish fess, abeg, make we commot that side jare, dem say Multichoice don enter government trap
Mazi: Shuu, no be dem Multichoice dey organize BBNaija show, how dem take enter trap?
Egbon: The agency wey dey collect Tax, FIRS talk say Multichoice bin dey owe government 1.8 trillion naira wey dem suppose pay as Tax
Mazi: Ah, that money tear mouth o, but why Multichoice self no do the thing wey dem suppose do
TB Joshua Laid To Rest
Egbon: The agency don talk say dem go carry leg put ontop Multichoice account, as e look like say dem no wan gree pay the Tax wey dem dey owe
Mazi: E no too jollof like that now, and i hear say dem dey make money well well for that BBNaija show o, you hear anything ontop TB Joshua burial?
Egbon: Hmmm, this life na just like paper o, if e by any means blow enter water, na the end be that o, dem don finally bury TB Joshua o, him don finish him own race commot field like this
Mazi: Kai, life sha, e now remain him and the thing wey him bin do when him dey alive, death na big lesson, but some people no dey gree learn
Boy Impregnates 16 Year Old Twin Sisters
Egbon: Very big lesson, nothing we bring come, and we no go carry anything go when time don reach to go, Mazi, con check this tory, dem say one boy wey him age be around 16 give these Twin sisters belle for Cameroon
Mazi: Ahh, Twin sister, which kain rough play be that, how old the Twins be?
Egbon: I hear say dem age too na 16 years old o, wo, make i con dey go my house jare, because i no understand the thing wey this world dey turn to
Mazi: Ohh, we go see later