Egbon: Las las, Federal Government don pack Ibrahim Magu put for one side
Mazi: Na why dem talk say this life na soldier go, soldier come, na only barack no dey commot go anywhere
Egbon: Gbam, I just dey check the internet, naso i see say Buhari don nominate the person wey go be EFCC Oga
Mazi: Ehn ehn, na wa oh, I bin dey think say dem still dey torchlight him matter now
Egbon: Na so me self think o, but as e be now, e be like say music don change, dance step self don go another way
Mazi: So na who Buhari con take do the EFCC Oga now?
Ibrahim Magu
Egbon: The man name na Abdulrasheed Bawa, him age na 40 years, i con hear say Buhari don carry him name go National Assembly, say make dem carry stamp put for the name
Mazi: Ohhh, the thing na sharp sharp, dem no wan waste time at all
Egbon: This wan wey we no con hear anything ontop Ibrahim Magu matter again, make e no be say dem don carry eye commot for the allegations wey dey him neck
LCC Counts Losses
Mazi: Na why plenty people no gree believe say this government dey fight corruption be that, dem go just do do, commot eye
Egbon: Before nko, and na why everything dey as e dey for the country be that, government officials no dey fear to thief, sake of say, na talk talk people go talk, carry eye
Mazi: Hmm, i even hear say the company wey dey manage Lekki Toll Gate, Lekki Concession Company don dey beg people o
Egbon: Ah, why dem dey beg people, when judicial panel wey dey torchlight the matter never finish work
Mazi: Dem talk say the loan wey dem carry put for head no be here, say dem no go fit pay the loan if dem no re-open the Toll Gate
Egbon: Wetin go con happen to the family of the people wey pai for that Toll Gate o, that one no be talk jare, make we talk better something
Congratulations To Okonjo-Iweala
Mazi: Na which one con be the better talk o?
Egbon: Clap…, so you never hear say the Organization wey dey chuk mouth put for trade matter worldwide don confirm say na Ngozi Okonjo-Iweala be the new Oga patapata for the body
Mazi: True true, na better news, i talk am, i don already see am say na she go win am
Egbon: Pele o, Prophet Mazi, Idibia Oshanyan, na who no know say na she go win after Trump don lose the election
Depression Is Real
Mazi: The wan wey i see clear pass anybody own o, i too like that woman, con check this tory o, dem say this guy don commit suicide
Egbon: Eeyah, na wa oh, how the thing take happen
Mazi: Dem say the boy naa final year student him be for Federal University of Dutse, Jigawa State, him go drink poison sake of say him girfriend go meet another man
Egbon: Kai kai, this wan dey painful o, but him no suppose do that kind thing, if girl or boy talk say him no dey do love again, person suppose move on
Mazi: Hmmm. some people no too get that kind mind to carry eye commot for person wey dem love o, dem even talk say naa valentine’s day the girl go meet another man
Egbon: Oga o, no be yesterday we still dey talk valentine’s day palava, this morning i don see one video
Mazi: Ehn ehn, wetin dey inside the video?
Egbon: One man catch him wife for one hotel where she go meet another man on valentine day
Mazi: Maka why, why some people like to dey do this kind thing self
Egbon: I don talk am before say na too much love for money plus greed dey cause am, we no fit finish the talk today, we go talk am again another time
Mazi: Ok, make i con dey go, we go see later
Egbon: Take care