Lai Mohammed Don Talk Again
Egbon: I bin dey think am some days ago say e don reach reach like 3 days wey i hear Lai Mohammed last o, sudeenly him just show like say him dey see wetin dey my mind
Mazi: Laugh…, You don dey add Lie join the complain wey you dey complain before o, Naa where Lai Mohammed show like say him see your mind
Egbon: Forget that thing, this one no be lie, naa Lai i dey talk about, Lai Mohammed Don Talk Again, him don chuk mouth put for the thing wey CNN talk ontop that Lekki shooting o
Mazi: Lai Mohammed Don Talk Again ?, i never hear that one o, naa wetin him talk ontop the matter, abi naa photoshop him call am too?
Egbon: Gbam, Naso the matter be o, him talk say the video no be confirm one con add say dem suppose sanction CNN self sake of say the investigation wey dem carry out no get leg
Mazi: But, i see the thing wey happen inside the video now, abi naa another one i see
Lai Mohammed Don Talk Again
Egbon: No be another one, naa that same one wey you see, CNN upload am ontop internet and plenty people don already see am, small small like this, we don dey know who dey lie and who dey talk true
Mazi: You mean say naa lie Lai Mohammed dey lie like this?
Egbon: No be me talk that one o, look my mouth well well, make you self use your teeth take count your tongue
Kidnappers Abduct Six Policemen, Demands 100 million Naira As Ransom
Mazi: Is ok o, I even hear say Criminals dem don kidnap six police people, con dey ask for money before dem go allow them go
Egbon: Hmmmm, Mazi, no be just ordinary police people o, naa Assistant Superintendents of Police dem be for Katsina State and naa N100m naira the kidnappers dey ask for
Mazi: 100 gini? that one naa big money o, if i add that one join my business, naa small go remain make i dey compete with Bill Gate, Dangote plus Otedola dem o
Egbon: No be only Bill Gate, naa Bill Window, you bin dey think say naa million dem gate, dem be Billionaire o
Mazi: Ehn now, no be small small i go dey gather the million wey go con later turn Billion, But wait o, who go pay the money like this?
Egbon: Naa you go pay am now, shebi naa dem family member you be, abi which kind question be that
Mazi: Person go ask you simple question, you go trun am to another thing
Happy Birthday To Goodluck Jonathan
Egbon: No dey ask me question wey no follow, i don tell you before, i even hear say today naa Goodluck Jonathan birthday, omo i don miss that man government
Mazi: Hiss… Go bring him government back now, you no follow the people wey dey complain that year say him too soft, him too slow, him do that, do this, now you dey miss him government after you don vote Iron bender wey no soft
Egbon: Abeg abeg, no take me catch cruise, shey naa only me vote Buhari abi naa my vote say make Jonathan no win election for 2015
Mazi: Dey there dey ask me questions o, you know how much dem dey sale Bag of rice, even onions self carry money put for head like Gold, anyways me i salute the man wey sabi
Egbon: We no kuku know say naa like this the matter go be, naa make God help us o
Mazi: Is ok o, we go talk later now
Egbon: Ok, take care