Categories: Uncategorized

Pidgin News (211): Rochas Okorocha Enter One Chance

Share

Egbon: This News wey i read ontop wetin happen to Rochas Okorocha totori my belle no be small

Mazi: Ah Ah, how that kind thing go dey totori your belle, na better thing make ekelebe arrest former governor?

Egbon: E dey sweet my belle sake of say the thing go fit serve as reminder say no long thing, power no be forever

Mazi: Hmmm, i never still understand wetin you dey try talk o, police arrest Rochas Okorocha webi former governor, you con talk say e sweet your belle

Egbon: Make i explain give you (cut in…

Mazi: I dey hear you, talk am make i hear

Egbon: You no say many of the politicians wey dey this country like to dey do anyhow sake of say dem get power

Mazi: No be lie, but wait o, na wetin Rochas Okorocha do self, why ekelebe arrest am?

Rochas Okorocha

Egbon: Inside the news wey i read, dem talk say him carry some people join body go re-open the property wey the state government don lock, sake of say the property na him wife own

Mazi: Ehn ehn, him no suppose do like that o

Egbon: You see, na now you understand the thing wey i dey try talk since, him suppose know say him no get immunity again and him no fit disobey the law

Kidnappers On Rampage

Mazi: Na why people wey dey position suppose dey do good be that, but wait o, wetin dey happen these days webi say kidnappers just dey carry people anyhow?

Egbon: Hmm, no be only kidnappers o, bandits dey do dem own, ritualist self no carry las, everything just dey happen like film

Mazi: Na wa oh, i hear say kidnappers carry one Monarch run commot for Portharcourt, dem carry one UNIPORT lecturer plus some people join

Egbon: Na as you dey talk that one my eye catch this tory o, i hear say gunmen don Pai three ekelebe people for Benin, Edo state

Mazi: Chai, this one touch my body o, just waste people life like that

Egbon: E never finish o, i still read say the gunmen con later kidnap the brother for Minister of Health, Osagie Ehanire

Boko Haram At It Again

Mazi: Government suppose do something quick quick ontop this security palava o before the thing worse pass as e be now

Egbon: No mind them, na so so Grammar dem go dey blow like fan, na the other dey Minister of Defence talk say make everybody dey their dey

Mazi: Imagine, and no be say government no fit stop these things if dem dey serious o

Egbon: Abi now, i even read for inside news say Boko Haram pai 5 people for IDP camp for Borno

Mazi: All these pai pai everywhere don taya me o, abeg, make we check better tory 

Adesua Etomi, Banky W Welcome Baby Boy

Egbon: Na where the better tory dey self, no be bandits, kidnap person dey hear up and down

Mazi: Me see one better tory here o, i hear say Adesua and her husband, Banky W don born

Egbon: Ope o, that one na better tory o, ah, me i dey happy for dem o

Actress, Adesua Etomi.

Mazi: Abi now, na since everybody don dey congratulate dem ontop social media

Egbon: Me self follow congratulate dem o, i hear say one singer like this, Bella Schuda murder Grammar when dem ask am question for Headies Award

Mazi: Ehn ehn, Sometimes, English dey hard o, but how him take murder the grammar?

Egbon: I don even forget how he take talk the thing jare

Mazi: I no too like make people dey laugh say person no sabi speak better grammar, las las grammar no be our own and na money be fine bobo

Egbon: Abi now, but at all at all, person suppose fit express himself o as e be say na bad eye the society dey take look person wey no sabi grammar

Mazi: Forget that thing, na Ebuka plus him brothers and sisters i go train make dem fit blow better grammar and i con still teach dem how dem go fit do buisness

Egbon: Tor, we go talk later now

Mazi: Ok, take care