Hello… Egbon, how far now?
Mazi, I dey o. How this lockdown dey do you now?
Nna enh, e be like say I dey enjoy am small small o. No stress, stress wey dey carry me go shop every day and my wife and pikin no dey disturb me for money to do anything because nowhere to go buy anything. I just dey relax
Aaah, na you piko. Me I no dey enjoy this lockdown at all at all. First of all na so so trouble my wife dey find for compound; I no even know as she take get the enjoy to dey quarrel up and down
I pray so. Ehen, I be wan ask you something
Wetin?
You know say government talk say for this lockdown, dem go give people money and I see am for NTA news yesterday say dem don start to the transfer money to people. Dem send to you? Or you know anybody wey dem don send to?
Egbon, if Nigerian government send me money you think say you go first ask me before I talk am. Dem no send me anything o and I no know anybody wey dem send to. I no sure say dem don start to dey money to anybody if not I for don hear of somebody for village wey dem give money
Na true you talk, all that wan na wash. Dem never start to dey send any money; unless na only people for north dem dey send to
Unless na so. Even the wan wey dem talk say dem go continue to give students food. I no know if don start
Forget that wan, dem never start anything; my neighbour pikin suppose benefit from that food wan and en never see anything and even if dem wan share food. How dem go share am for this lockdown? How the students go commot from their house go collect the food when dem talk say make nobody commot for house.
E be like say the whole thing na audio
Na audio my brother. No be to hold microphone dey talk? all of us fit do am.
Hmmm, every man for en self o. you see as some people destroy food for market because some of the traders increase the price to their food?
Mazi, make I talk true enh; I no feel bad for the traders wey dem troway their food. For this crucial time, how person go see say na the right time to increase the price of your Garri. Garri wey be essential food for us for this country
I understand wetin you dey talk but I still no support am. Highest, as the trader increase en price make people no just buy from am; make dem go meet another trader wey no increase en price
You know whether all the traders for that market increase their price and dem just use that woman for example? You dey talk as if you yourself no be trader and you no know how traders dey think for this country.
I understand wetin you dey talk but at the end of the day violence be the answer
Abeg leave English for English teacher and make we face reality. Someone dey do wickedness by increasing price of food and you dey talk say violence no be the answer. Na the answer for this case. If I be the one sef no be only the woman garri I go troway; I go also troway her rice and beans join
Egbon, e be like say na another thing dey worry you; because this your vex don turn to another thing. This lockdown don dey affect your brain
Mtshwww, no be on top my credit you go tell me this kind thing abeg
Your credit? Who phone who? No be me phone you? In short bye bye