Egbon, first of all wetin you dey do outside yourself and government no talk say make people no commot from house. No be wetin government talk be that. Them talk say schools and social gatherings should be cancelled, dem no talk say people no fit commot from house; e never reach that level and e no go ever reach that level for this country
Amin!! Amin! Because ehn, I no go lie; before wen this thing first start fear no catch me at all but with all the things wey dey happen so fear don dey catch me small small.
But you know say NCDC talk say no case of corona virus dey Abuja and that na good news
Enh, e be good news but as long as the virus dey this country; e mean say e fit still enter Abuja. To be honest enh, I even dey surprised say the thing never reach Abuja
Even me sef but e good as e never reach o because I no know wetin I go do if e reach this town. The things wey government dey do now na the way to go
Yes. Closing of schools and religious gatherings
But people go hear word? Dem go still go church
If church dey, closed you go go? That one na the job of the pastor to tell en members to watch service from home especially all these big big churches
I even hear say El Rufai tell all muslims to suspend prayers wey dem go have to pray with other people for mosque
Hmmm, no be small thing o. Even Waec sef, dem don postpone am and all CDS related activities relating to NYSC corpse members dem don stop am for now
That one better now, I pray say very very soon dem go gain control of this virus
You hear say Chloroquine dey cure corona virus?
I hear am but the thing be say dem never verify am o. no go dey drink Chloroquine for no reason; na trial dem still dey do
Hmmm, this thing wey you talk so; na pharmacists you go tell because people don dey rush go chloroquine anyhow and the price don double
Na wa o. na our Nigerian way be that; instead of people to verify something before action, na to take action before verification.
My brother, no be so dem do for that Ebola time wey people dey drink salt saytay the salt kill dem
And na so Lagos talk now say dem don dey receive patients for lagos hospitals with Chloroquine poisoning. People don dey drink chloroquine like paracetamol
Na wa o. from one wahala to the other. My country people if you get any symptoms like corona virus no go dey drink chloroquine anyhow oo. First go hospital make dem test you and confirm say na corona virus true true na em you get.
For this crucial time self-medication no be the way ooo.
At all oo. If you start to dey self-medicate; you fit create another problem for yourself. The fact say government approve the production of chloroquine no mean say make you sef go buy am dey drink for house
Government and health workers no how dem dey use am treat corona virus and the dosage wey the different body type suppose take
Exactly. Mazi, you don full you house with food stuff in case government come talk say make we no leave house?
Na em me and my wife wan do today o
Even me sef, make I even come dey go.
Alright.