Egbon and Mazi

Pidgin News (284): Nnamdi Kanu Confesses

Share

Nnamdi Kanu Confesses

Mazi:  I never still understand the thing wey federal government dey talk ontop this Nnamdi Kanu matter o

Egbon: Na as the thing confuse you, e still dey wonder me self o, make dem no sha allow make the thing turn to another big palava 

Mazi: The only thing wey no go make the matter turn to another thing na say make anything bad no happen to Nnamdi Kanu, because if bad something happen, him followers no go take am easy o

Egbon: If no be say this federal government no dey waka straight self, why e be say na Kanu plus IPOB members dem dey find up and down, how many Boko Haram plus Fulani people dem don carry go court since

Mazi: Na why some people dey complain say the government dey baise be that

Nnamdi Kanu

Egbon: Shebi i don dey talk am before now, Sheik Gumi dey waka like say na him papa get Naija, dem no fit do anything, na Nnamdi Kanu and Sunday Igboho dem dey find like gold

Mazi: Wait fess, wetin Kanu talk after dem carry am go court?

Egbon: According to the thing wey i hear, him talk say the reason why him run commot Naija na to safe him life

JAMB Registrar Raises Alarm

Mazi: No be lie, if him no run commot, dem fit kill am, make we siddon dey wait how the matter go be now, but make we no lie plenty people fail this year UTME o

Egbon: Hmm, no be small thing, the failure no be here, i dey hear say some people even score 100, some 40, the result really dey poor 

Mazi: Kai, why dem no go score that kain mark when e be say na ontop internet plenty students wey suppose dey read book dey stay 24/7, dey chat everytime, instead make dem dey read their book

Egbon: JAMB Oga even talk something ontop how some Higher institutions dey collect money carry certificate give people wey no go school

Aisha Celebrates Daughter’s Graduation In London

Mazi: Imagine, na why Education con look like something wey no get head again for this country

Egbon: Me i no too blame the students o, the people wey dey leadership position for this country no try at all, how dem go even try when their pikin no dey go school for Naija

Mazi: Hmm, na wa oh, shey na like this we go dey dey

Egbon: My brother, the matter no be here o, i see one tory where Aisha Buhari dey celebrates her daughter wey graduate from Royal College of Art, London, United Kingdom, and you dey expect say dem go take Naija education serious

Davido, Tiwa Savage, Others Mourn

Mazi: I still get hope say Naija go better, na the exact time I no fit talk, but, one day one day, the country go become great again

Egbon: Ohh, i hear you, you hear say one of the people wey dey follow Davido pai?

Mazi: Ahhh, i no hear o, how the thing take happen?

Egbon: Dem never talk wetin happen to him o, dem say the guy name na Obama Dmw, say na Davido personal assistant

Gunmen Kill UNIBEN Final Year Student

Mazi: Kai, the way young young people dey die these days dey give me concern o, make God dey keep us, make bad news no reach our dommot

Egbon: Amin oh

Mazi: Con check this tory, dem say some people wey carry gun go kill this guy after him write him final year exam for UNIBEN

Egbon: Ehn ehn, which kain thing be this, if we look am well now, e possible make e be say the guy dey cult, whether him too don pai some people before

Mazi: Hmmm, this cult something, i no just no why some people never see say e no dey pay, now him just put him family inside pain, i wan dey go my shop

Egbon: And some people no go still learn from this wan wey happen now o, take care jare