Egbon and Mazi

Pidgin News (25): Femi Adesina dey Find Trouble

Share

Egbon, you hear the thing wey that useless man talk?

Mazi, which useless man and wetin en talk?

No be Femi Adesina, en talk say if no be say we elect Buhari; this country for done die tey tey

Which kind yeye talk be that; abi no be Buhari wan kill this country?

My brother, the thing wey dey pain me for all these politicians and journalist wey sabi talk well well; be say dem sabi talk according to their own selfish gain. If Femi Adesina no dey gain anything for this Buhari government, en for no talk the nonsense wey he talk now

Na so e be, all those so called activists and political analysts, Femi Adesina oo, Femi Falana o, all of them go talk one thing now and when something happen dem go change mouth. I don even tire to dey vex for their matter

I never tire and I go dey vex until den stop the hypocrisy and sycophancy

Den ready yourself to dey vex well well and who come teach you this big big English wey you talk now now?

Na my pikin teach me o, I no even know the meaning but I know say e enter the thing wey we dey discuss

Ose, I hail you. You hear say Abacha family carry government go court say dem been wan carry all the money wey Abacha loot the time wey en be president

Na wa o. Some people get mind sha; Femi Adesina no go see case like this wey en go criticize the Abacha family

Ha ha, Femi Adesina no dey fear face? You think say problem no get levels. But court throway the case sha, talk say dem no go give dem access to such stolen money

But why dem been wan collect the money? I think say Maryam Abacha talk wan time say no matter the amount wey government seize from her husband she and her family will never be as poor as Dangote

Ahhh! Na wetin she talk be that?

She talk am live oo. I no dey lie for you, ask other people and them go tell you

Maybe the money don dey finish; you know say dem get plenty children for that family and all those children don born more children

My brother na truth you talk. Maybe the money no do them again and shame don dey follow dem small small. But the truth be say I no know of any president for this world wey steal money from en country like Abacha

Honestly, you know say na print dem dey print dey money for am?


Chai, some people come this life to chop am o

And dem chop am well well. From Lagos to London to Italy and Germany and back to Lagos

Gbam! Speaking of Lagos, Bubu talk say e get some people for Lagos wey dey live for Victoria Island and dem never take one leg enter Ikeja before for their life

I no believe am, airport no be Ikeja e dey? Those people wey dey Victoria Island na dem dey get money pass to dey travel for aeroplane like bird

Exactly and I no even know wetin concine Bubu with people wey never enter Ikeja before; how that one take change price of garri for market?

Bubu no dey chop garri o, so nothing concine am with the price of garri for market; na people like Femi Adesina e go concine, In short na sand those kind people dey chop

Egbon!!

I lie?

I no know for you oo. Abeg make I come dey go house, serious hunger dey wire me

Ahn ahn, I been think say you wan buy us food now

You give me money to buy you food?

Ahh, sorry o. No vex abeg