Omoyele Sowore
Mazi: Laugh… nothing wey man no go hear for this country o
Egbon: Which wan you see again o sake of say plenty Drama dey inside Naija, na one day, one drama
Mazi: No be Sowore i dey look so, i hear say him carry juju enter court where (cut in
Egbon: Ehn ehn, na wa o, no be small something, but this picture wey i dey see no show say na him carry the Juju enter court now
Mazi: Na who con carry the thing, no be Juju man dey him side for inside the court like this?
Egbon: No be same thing, na Juju man Sowore carry enter court no be say na him carry the Juju enter court
Mazi: Anyhow, the koko na say why him carry Juju man enter court, him wan go take Juju follow Judge talk
Egbon: Laugh, no be so Naija politician dey turn deaf and dump, wey head, leg, hand go dey pain dem if dem say make dem carry dem go court
Mazi: Tor, Drama no go finish for Naija o, wetin be the latest ontop COVID-19 vaccine, e don enter
AstraZeneca COVID-19 Vaccine Don Land
Egbon: Finally finally, the vaccine don land o, na ontop television i see as dem go check the thing for airport
Mazi: That one na better something o, las las, Naija don get COVID-19 vaccine
Egbon: Me i never beleive say Naija don get vaccine o (cut in
Mazi: You no get conscience at all, no be now now you talk say vaccine don land for Naija, why you con dey change mouth again?
Egbon: Me wey talk say vaccine don land, wey con later talk say e never land know wetin i see wey make me talk am o
Mazi: Abeg, talk make i hear wetin dey your mind, why you talk say vaccine never land
Egbon: Ose, thank you for the question, physically vaccine don land, but, na until common man see am use i no fit gree say e don land o
Mazi: Hmm, but why you be like this self, vaccine no land you dey complain, e land again, you still dey talk say e land, e no land
Egbon: No be naija we dey again, wey those politicians no go allow make the thing reach poor man pikin
Mazi: Make we get hope say e go reach common man, i even hear say anybody wey him age dey under 18 years no go collect the vaccine, maka why
Egbon: Na Doctor dem fit explain that one o, my own na say make the thing reach the people wey e suppose reach, make dem no make am be like palliative own
Jandebe Students
Mazi: This Egbon no dey forget something quick quick o, so you never forget this palliative something
Egbon: How i person go forget that kind thing, e dey always pain me say most of the people wey dey government no dey talk true
Mazi: Dem don talk another lie?
Egbon: E get anytime wey dem talk true, i hear say dem don release the students wey bandits carry for Jandebe Zamafara state
Mazi: How that one con take resemble lie?
Egbon: For me o, i dey suspect the people wey dey government, i notice say na new clothes dem give the students, na who be the Tailor
Mazi: Laugh, Egbon Egbon, shey na who be the Tailor matter now or make we thank Chineke God say dem don release the students
Egbon: I no talk say make we no thank Baba God, the thing wey i dey try talk na say the thing look like say na arrangement something, maybe na game dem dey play
Mazi: Hmm, na God no pass
Sugar Daddy Vex
Egbon: True true, na God no pass, but the little wan wey i know, i go talk am
Mazi: Talk am o, i hear something wey funny me o, dem talk say one Sugar Daddy dey try to spoil the car wey him buy for him girlfriend for South Africa
Egbon: Na wa o, this thing con dey popular these, na the other day i hear say one man scatter the house wey him build give him opeke too
Mazi: Odikwa serious o, i dey even read one tory wey talk say pastor wife for Adamawa carry her husband go court say she no wan do again
Egbon: But why, kilode?
Mazi: She talk say the husband eye no dey one place, say him dey do plo plo for him church members so tey him con get three pikin for outside
Egbon: This wan full mouth o, Mazi, make i con dey go, i wan go try see if i go see fuel buy
Mazi: This fuel matter na serious something o, we go talk later now
Egbon: Bye