Egbon and Mazi

Pidgin News (13): Boxing the Tenant Who Won’t Hear Word

Share

Egbon, you dey watch boxing?

Na wa for you Mazi, these days you just dey ask me some kind question out of the blue. I no dey watch boxing o

Ahn ahn, how come? No be you talk say you dey watch wrestling?

Wrestling and boxing na the same?

Both of dem na to fight now

But their fight different. For boxing na blow dem dey take knack their head and for wrestling na as e do you, anywhere wey you wan knack the person

All these wan wey you talk now now na English; as you no dey watch boxing, e mean say you no know who Anthony Joshua be

How you go talk that kind thing? E get any Nigerian wey no know Anthony Joshua? No be boxing heavy weight champion en be? Na Yoruba boy now

Wait… I think say na igbo boy

Who dash monkey banana, no talk that kind thing. Na Yoruba boy en be

Wetin you mean? Say igbo boy no fit be heavy weight boxing champion?

God forbid oo. No be me go talk that kind thing… I just dey clarify for you say Anthony Joshua no be igbo boy period.

I don hear. People for this world are wicked o. Nigerians dey like to complain say na only government dey corrupt when Nigerians dem selves gunh gunh are corrupt

Wetin happen?

See wetin tenant do to landlord house because en no fit pay rent and dem give am quick notice

Na wa o. see as en destroy the roof

Honestly people can be wicked and if you ask him now; he will tell you that he also wants to become a landlord one day

Na their God go catch, all the tenants we yen go come get; na hell fire dem go come from. Dem no carry the man go police?

The landlord talk say dem report am to police but the man sabi bribe en way from the hands of the law

You see! Another Nigerian problem, in fact one of our biggest problem in this country. Police bribery

I’m telling you. And no be just police bribery o… e even get how e go reach dem no go even collect your bribe if you no be VIP for this country

Yes. I don see am before; my neighbour wey dem rob go report to police and till tomorrow dem no do anything because he is not related to anyone in government. He is not important to them

You no see one video wey show one police man dey use POS machine dey take collect bribe?

Ehnh! For where?

I no know, I no think say na this town. But en dey use POS and en dey even harass people wey no wan commot their bank card give am

Bribery everywhere, no be the same bribery wahala put Shehu Sani inside wahala so?

But en talk say na frame dem dey frame am

I no believe am. Na bribery situation gone wrong. The owner of ASD motors talk say Shehu Sani tell am make en bring ten thousand dollars so that en go give Ibrahim Magu to investigate a case for am and as the man bring the money en come talk say make the man go bring another ten thousand dollars for Chief Justice of Nigeria; na their yawa come gas

So wetin that wan come mean now? If this tori na true that means en wan implicate Ibrahim Magu for en bribery scheme be that o

Tor, why do you think he is being persecuted? But last last it still fit be set up

Exactly, so make we no just jump into conclusion. Na so people dey take break leg

Which kind dry joke be that?

Na my small joke dey pursue you? Where you come dey go now?

I dey come