Egbon and Mazi

Egbon Jimoh (Episode 23): English Speaker

Share

Press play to listen to this article

The kain sun wey dey mama person these days, I no just understand o

Egbon wait mey I ask you something. Upon all the money wey you don dey save for the past how many years now, why you never still buy motor?

See Mazi, in life you have to prioritize and make sure that you do not indulge in liabilities that will exhilarate the extent of your…

English… I never even ask question finish o, you don dey blow am again! Egbon, you be akagum, that’s what you are!

Same to you Mazi, same to you. You don see another governmental disgraceful news?

See enh. If you speak all these your English again, I go come dey go my house

Beht why you no like my English? English is a universal language and it’s something you have to keep learning. Dey no dey learn am finish na. You see as Nassarawa state first lady no fit read her speech well for English

Na she do herself, she for read for Hausa make the media people translate am. If person no sabi speak English, e no be crime

E no be crime but a whole first lady should be able to speak good English

Abeg, make I hear word. Na this kind talk dey make me vex. You don ever see Chinese president dey speak English? Abi you see don see say they kill Spanish president because him no fit speak English?

No be say we wan kill am but…

Go hear that Bright Chimezie song ‘because of English’. Because of English una no go allow that woman rest. Anyway, na she do herself, she for just do the speech for hausa.

Mazi relax, no be me write the news na

But you one are one of those mocking her

Nawa o, because I tell you something now, I don carry gbese for my head

You know say Rochas son in law don lose to Emeka Ihedioha for Imo state

How e no go lose? Rochas no be serious person. E don do governor finish, e come say make en son in law do again. Ahn ahn, na family business?

If you ask me, who I go ask?

For say en son in law win, after that one tenor e fit say make en pikin come do again.

Na so dictatorship dey start

Omo, na so e dey start o. You no see for news say Buhari dey push for a change in the constitution to make his term 6 years

Tah, he no fit do am

He fit oo. No just underestimate that man, see as en start by making Osinbajo role useless for Aso Rock

That one na him do himself. En eye service too much

Tor, we don see am now, en eye service don open en eye. Mazi, these yahoo boys get liver o. E get one wey still dey run things from prison

From prison?

Ahn ahn, wetin I just talk? He don dupe people for the amount of one million dollars

Ehn!! For how much?

One Million Dollars!

From prison?

Yes ooo, from prison

Okay

Read also: Egbon Jimoh (Episode 22) Akara For Votes

Mazi, where you come dey go?

I dey come

No go do yahoo yahoo oo