Egbon and Mazi

Egbon Jimoh (Episode 21): Keke Vexation

Share

Press play to listen to this article

Egbon, this one wey you dey sweat like Christmas goat, Christmas never come o

No just allow me vex for you, Mazi

Wetin dey worry you? Dem no fit follow you play again?

Abeg, play get level. For this hot sun, I waka from Apo all the way to Area 3 Junction. The sun wey mama me today. I never see for my life

Ahn Ahn. Na you wan trek now. Wetin do keke wey you dey carry before?

Mazi, why you dey talk as if you no dey this country? Government don ban keke!

Oh my God! No wonder I no see keke as I dey come this side. Come oo this our F.C.T Minister get brain at all? You know how many mouths this keke business dey feed?

I just tire, I don vex tire. My vex don dey vex and en vex too don tire; which kind wahala we Nigerians enter because we wan vote for change. Na curse say person be citizen of this country?

Egbon, na curse. I don gree say na curse. If no be curse, how person go wake up one day say make them stop the easiest form of transportation for your state. Transportation wey dey help thousands of people ooo

Thousands? Abi millions. E no get as anybody for this town go tell me say dem never use keke. Na all level of income earners dey use this keke one way or the other. Mtshww, kai… if I talk say I never tire enh. Na big lie. My morale don die finish

If your morale don die. Wetin you want make the morale of keke drivers to do? I dey here dey look the five billion wey Otedola give em pikin; I no know say you dey come with another bad news come join am

How you go talk say Otedola news na bad news. No be say na em pikin he give the money, na charity e give

Who be this Charity?

No. Na charity organization, see Mazi no stress me with question o. I still dey vex.

Make you handle your vex because na another question na em I wan ask so. This five billion wey Otedola give charity organization, na every year e go dey give dem the money or na once and for all?

How I go take know now, I be en accountant? Anything wey en like make e do with en money

See your Sowore, dem talk say e no dey chop; that he is doing hunger strike as a protest

If he likes he should eat sand, that is his business

You dey vex o

Wetin I dey talk since? It is now very blatant that government cannot even hide the fact that they don’t care for us. All of them can go to hell and burn to ashes. Sowore oo, Osinbajo oo… anything wey dem like make dem do

But Sowore no be government now

The time wey he dey New York dey chop money for Sahara reporters, wetin en do for us Nigerians. How many Nigerians en epp. Abeg make dem allow me hear word. Hunger never catch am, if e catch am e go chop

You know say this protest thing get as e dey be sometimes. I believe him not eating is even giving government what they want, hunger fit kill am den wetin be dey point. Nelson Mandela wey dem hold for prison for twenty something years no do hunger strike because hunger would have killed him and he would have never become one of the greatest African presidents.

Read also: Egbon Jimoh (Episode 20) Fashola, Say What?

Mazi, na you get energy to talk. You no hear wetin I talk now, anything wey dem like make dem do with am. All these people are just selfish. Very selfish.

Where you come dey go?

I dey go office, my leg dey pain me. I no fit stand again

Okay oo. This small trek wey you trek now, I no fit drink water put cup down.