Egbon and Mazi

Pidgin News (3): Inspector General Likes The General Public

Share

Egbon, this one wey your shirt squeeze like this; you no get iron for house?

Mazi, abeg leave me I no get energy for your wahala today; no be inspector of police you be. Just dey your own make I dey my own

Why you come commot for house if your body dey pepper you like this?

How e no go pepper me? Ever since this NEPA strike I just dey vex anyhow because my gen don spoil

Strike don end now. Dem never bring light for your side?

Una get light?

Dem don bring light for my side since… I know say the strike no go last now; which kind lie lie strike be that? The people wey dey do strike no dey use light for their house? Mtshw… maybe una transformer spoil

I just tire, strike or no strike I don tire

If you don tire, wetin you wan make I do? The goods wey I wan export never commot this country for the past two months

Ahn ahn, Mazi. You never tell me say you don change from importer to exporter

Hmmm, me wey I don dey do the two since… wetin be that thing wey you dey talk every time “ehen, it’s always good to diversify”

That’s very good but I read say gridlock for port na die. Dem talk say e dey cost this country up to six hundred million a month

E go reach because it is very very bad, they really have to do something about it. A lot of people are losing money.

“Na inspector general you dey go meet?”

But what is wrong with Nigerians?

Wetin happen?

Petrol tanker collapse for Lagos and Nigerians are there fetching PMS. Dem dey there dey fetch petrol

Nigerians no dey hear word. Poverty no dey gree people to hear word, upon all the tanker explosions wey don happen for this country na em dey still dey go fetch petrol. Which time people go learn say when you see petrol tank wey don spoil, run commot from that place

I no just know. If this one explode kill people dem go say another catastrophe don happen

 Speaking of catastrophe, you see say inspector general of police don end that useless PDP rally for security reasons?

I see am o. The Inspector made a very good decision because I no know the time wey dem done dey do rally to welcome members into party it’s not to spite division and fight in the region

You talk well, these politicians in their selfish attempts to gain power make decisions that put citizens at risk. The inspector general do well

The Inspector general do well. Your first lady say she no dey get bedroom talk with her husband again

Who get the fault for that one?

She talk say work no dey gree dem talk for bedroom for night

Na she no wan talk to am abi na dem no wan talk because e no get any kind work wey I dey do wey no go allow me and my wife talk except we dey quarrel

You don answer your question now, Aisha and Buhari no dey quarrel? No be so so quarrel dem dey quarrel? And their own quarrel no get shame because na for public dem dey do am

My brother, no be the one wey she wan talk she talk; make we see whether her husband go reply

En fit reply talk wan kind nonsense talk, like the one wey he talk that time… Wetin he talk that time sef?

My wife belongs to the kitchen and the other room. Chai. Na that kind talk person go talk about en wife to the public?

If you ask me, who I go ask

Hmmm… Make I come dey go… E something wey I wan do

Na inspector general you dey go meet? Okay, go well