Egbon and Mazi

Pidgin News (9): Christmas Clothe For Sowore

Share

Egbon, you still dey wear Christmas clothe? Because this your agbada get as e be

Christmas clothe kor, boxing day clothe ni. This agbada wey I don get since 90 ogogoro

How I go take know say you don get am since and with this heat wey dey mama person, you dey wear agbada; na em make me think say na your Christmas clothe be that. Me I be think say you wear am because dem don release Sowore.

Me. I go come wear Christmas clothe to celebrate Sowore, who en epp? Abeggi. E better say I just wear am for nothing

As you dey wear Christmas clothe dey show yourself say you get money robbers go soon follow you go house

Mazi, why you dey like to swear for me

I no dey swear for now, I just dey talk true abi you know hear the robbery wey happen for bank for mpape?

E get anybody wey no hear of am? The robbers no get sense, dem be think say as na weekend police no go show

And the police plus army show up well well. The wey dem take respond to catch the thieves increase the respect wey I get for them

See enh, no be say our police and army no sabi their work o. I know say dem sabi but the environment of the country no dey allow dem manifest their intelligence well well

Egbon, you too dey speak English. How country environment no allow dem do their work. As dem do this one well, dem no receive praise? Na so so praise and respect Nigerians dey spray for dem. If to do your work dey hungry you true true, you go do the work regardless

Mazi, na true you talk. you see say one banker dey among the robbers?

I see am o. Na wa o, these bankers just dey fear me every day. As you see me so, I no dey tell any banker about all my transactions; even my so called account officer

The thing be say, whether you tell dem or not; dem fit find am… e go dey their system and dem fit fish am out

Hmmmm, so na so we go just dey risk our money dey put for bank

But e better say you put your money for bank wey dey insured than to put am for house. Anything fit happen for house, your wife fit carry am, water fit pour am and fire fit catch am sef

Hmmm, Egbon this wan wey you just talk na true o. And if I put money for house and my wife carry am, e no get anything wey I fit do; wetin I go do? Na bye bye to that money be that

You don talk am. People still dey smuggle rice enter this country o

How you take know?

Ahn Ahn, you no see am for news? Dem don intercept plenty bags of rice wey dem smuggle enter Ebonyi state

Ehehn, I no know o. na only rice dem see? If people den take rice enter, I promise you that there is more

I agree, they are smuggling more than just rice into this country; na the one wey dem see be this

Egbon, I no come understand una traditional leaders again o

Wetin happen?

How you go ask me that question as if you never hear say Olowo of Iwo and en wife don divorce

That one na news?

Na news now, how Yoruba traditional leaders go just dey divorce anyhow? First na the Ooni of Ife now this one; shame no dey catch una?

Mtshw, if shame catch us, wetin you want make we do? Make we kill am because en marriage no work? Na so life be?

No be so

Den wetin you come dey talk? Na divorce en divorce, no kill person en kill

Tor, I don hold my mouth… I no go talk again. If Olowo of Iwo wan divorce na en business

Ehen, na wetin you suppose talk be that. Na en life

I don hear. Make I come dey go

So soon?

I go see you tomorrow

Okay o