Egbon and Mazi

Pidgin News (83): Father’s Day Is Not Our Day At All

Share

Egbon, how far now? Happy father’s day o

Aaaah Mazi, I wish you the same. Wetin dey happen for this father’s day now?

Nothing o. my pikin buy me small gift

Ehen, that is good. My children no buy me anything o; na only deir mama dem know. Any small thing, mummy this mummy that… what can we do for mummy for mother’s day but wen e rich my turn… norring.

No mind dem, you know how children and their mama be. Even me sef shock as I see say my pikin buy me something for father’s day; normally dem no dey even remember say something like father’s day even day sef.

My brother, me wey dey talk sef… I no dey remember say anything like father’s day dey sef

Ator. And you know say if dem no carry mother’s day for head na wahala be that because their mama no go allow dem forget; you know as women dey now

My brother na true you talk. the true joy of father’s day no be any gift… na say all our children dey alive and well

Nne enh, na the original gift be that because I no even fit imagine the kind pain people wey don lose their pikin to death dey feel

And may you never fit imagine am

Amen o. my brother you don hear the latest news on the flight situation?

I never hear o. wetin dem talk?

Dem talk say both international and domestic flights no dey resume at the time wey dem talk say dem go resume again o

I talk am. Coronavirus cases dey increase and dem dey there dey set date on when to resume flights; no be upside down thinking be that?

Honestly, priority now no be to dey fly like bird; priority now na how to end this coronavirus kpata kpata.

End wetin? The only thing wey this government fit end na money

Ha ha ahn ahn… how you go talk that kind thing?

I lie? As of now, Nigerian government no dey do anything with the science wey dem get to come up with cure for corona. The only thing wey dem dey do na to do breebree… and to take style dey wait for the cure wey oyinbo man dey work on. Na lie I talk?

No be lie. But what about the cure wey Madagascar talk say dem don do that time?

If you ask me, who I go ask. As dem talk say Nigeria suppose pay money for the cure that time… tori end. We no hear anything about am again, abi you hear something?

I no hear anything about am again o. if I hear, I go dey ask you?

Flight no be anybody problem now… make dem no just rush open the flights because e go come another extra wahala.

Make we wait dey see now. Chad talk say make we give dem electricity

I no understand. Make we give dem electricity as how?

Chad say dem no too get electricity and to complete their own electricity, make we allow dem connect to our own electricity and our minister of power gree for them

Ha ha. Which electricity dem wan connect to? Dey wan wey we no get? Or na generator dem want?

My brother, minister of power talk say if we give dem electricity e go increase our relationship with them.

Aaaah! So dem wan carry our electricity wey no even do us carry give another country, wetin chad don for us… who chad epp? This your news don spoil my father’s day.

Abeg take am easy o. no come get heart attack for father’s day; no carry this matter for head, just leave am.

Hmmm. May god help us for this country.

Na so.