Egbon and Mazi

Pidgin News (41): Oil is a Blessing and a Curse

Share

Egbon, this wan wey you dey run like this wetin happen?

Mazi, there is fire on the mountain. Oil pipeline burst for Ibadan and fire don start. I no know…

Wait wait wait. Who tell you say na Ibadan?

No be for Ibadan?

No be Ibadan, na Abule Ado for Lagos

Aaaah, thank God.

Why you come dey thank God say oil pipeline don catch fire?

No ooh. No be wetin I mean be that. No be say thank God say fire dey lagos but enh, I think say na for the area wey my pikin dey right now na em make me dey fear dey run anyhow

Ehenh, you pikin dey Ibadan?

Yes, she go buy a few things for her mama. As for the fire for Abule Ado na wa o. that na serious fire o

No be small thing. The fire even affect one school wey dey around that side and the school principal don die

Aaaah, egba mi o. just like that?

Just like that o. she been dey save some of her students from the fire and na so she no fit save herserlf.

Mazi, I wan understand something. This oil wey we get for this country, na blessing abi na curse? Because every day na so so fire fire and if e no be oil tanker cause am den na oil pipeline. E don too much now

Nna enh, I even think the same thing as I see this news this morning. We get oil for this country wahala and if we no come get the oil again that one na another oil

Go no go, come no come agbada hook wire

Na real wire my brother. You see the thing wey dem dey do your APC Chairman. Dem wan disgrace am from office completely o

Hmmm, I dey follow the news. Tinubu don even talk am say dem go commot Oshiomole as the national chairman

Na wa o. wetin the happen for this country. First na Sanusi, now oshiomole. Dem just dey remove remove people from one position or the other.

Na dem know o. all these one wey dem dey do Oshiomole anyhow I sure say na just because en no do one small thing wey dem want

How you take know that one now?

No be so politics dey? Dem go dey support you until you grow mouth tell dem the thing wey dem no one hear, go aske Ambode now.

As I dey think this thing wey you dey talk, e be like say na true talk

E no be like anything, na true talk. All these political wahala na ego of men dey cause am. Who get power pass who. Who go fit show enself pass. All na nonsense

Yes o, all na nonsense but for them and the way wey e dey affect their family  e no be nonsense.

Look, as dem dey do Oshiomole now, no dey surprise if en settle with en party and dem come give am one political position

Hmmm, na so e dey be

My brother na so. Make I come dey go

Okay o.