Egbon and Mazi

Pidgin News (40): Sanusi Doesn’t Want to do Again

Share
Egbon, dem don release Sanusi. I think Gaduje dey above the law now. En for no release Sanusi.

Mazi, no be say Gaduje dey above the law but the truth be say we no know the quarrel wey don dey between Ganduje and Sanusi

That one na dem know. Court tell Ganduje to release Sanusi that e dey unconstitutional to hold am in detention after dem don dethrone am

No be lie. You don dethrone person and you wan put am for detention as if na crime en commit. To disrespect person no be criminal offense and Ganduje no try as en do that one. You see the house wey dem put Sanusi?

I see pictures o. one dead two bedroom house like that for Awe; if you see the baff enh, e be like say dey baff go collapse if you climb inside

Ator, person wey e no like, you think say Ganduje go put am for fine house or for mansion?

Na true sef. But Sanusi don run commot from that place o

How en no go run. The moment court declare say make dem release am; en no even waste time, he enter aeroplane commot that Awe town quick quick.

So where en dey go now?

Person wey get houses everywhere for this Nigeria na em you dey ask question. En go go anywhere wey en like. But I hear say na Kaduna en go first

Enh, na true. En go go meet en friend El Rufai before any other thing

After Kaduna, e be like say na Lagos next.

Ehen, why Lagos?

You don forget say na Lagos en dey before den carry am do CBN governor dem Emir of Kano

Oooh na true sef, I don forget. En be banker before and na for Lagos en be dey stay.

Hmmm, I wish him well in his endeavours. But how far en court case?

Which court case? No be court case wey dem release am from detention now now?

No no, I mean say en no go challenge this en dethronement for court?

See am now, this newspaper write am; e talk say en no wan challenge en dethronement for court because en no wan return as Emir of Kano

Ehen, maybe he done tire

Or maybe en no get energy to dey do court case up and down. You know say court case fit drain person energy well well and some cases go last for years. The wahala too much

I swear and as una dey go the court for years, e no go guarantee say na you go win for court oo. Everything na gamble

Everything na gamble my brother. Make e just go rest, the one wey e do, don do; en try.

Mazi, see serious wahala o.

Wetin?

To change one dollar, na four hundred and twenty naira you go use now oo

Egbon, I don see the news; na serious wahala because I just dey think of the way I go buy my goods and I no go increase my price for market because if I increase my price for market, I go start to dey lose some customers.

Hmmm, how you go do now?

The only thing wey person fit do na to wait and see if the price go come down

But if the price of dollar no come down, CBN go intervene now. Dem dey do am normally

Yes dem dey do am but no be every time. The only wey dem intervene well well na the time wey dollar been almost reach six hundred naira but for now, we go dey watch dey see wetin go happen.

I pray the price reduce sha

I no think say you pray that prayer pass me

Whether e pass or not, all na prayer

Okay o.