Egbon and Mazi

Pidgin News (39): Sanusi don Enter Pepper Soup

Share

Mazi, there is fire on the mountain

Egbon, wetin happen?

You never hear? You never hear say dem don dethrone Sanusi as Emir of Kano?

My brother, I hear oh. No be small thing oh. Nna enh, water don pass garri

No be only pass garri, e don overflow wash the garri commot from plate. Kano government talk say dem commot am as Emir because en no dey co-operate with the government; that anytime wey dem invite am for meeting en no dey come at all at all

Na wetin dem talk be that? I no believe that story abeg. See en e like say dem wan ridicule Sanusi because en wan run for election in 2023

Hmmmn. Na wa for this life. You know say dem don put am for house arrest abi na exile

Enh, na exile I read, say for their culture if dem remove king; en go go exile for a while and en no go fit commot from en house.

So na house arrest en dey now?

E be like but e be like say en don commot from Kano. I see for one newspaper say dem don quickly carry am go Nassarawa or something

Na wa o. which kind overnight wahala be this? Come see this newpaper. Dem talk say en don carry the case go court.

That one na normal thing o. If he no carry am go court then na there I go insult am

Yes. Because en get right to carry am go court. For the history of Kano state; I never hear say dem remove their Emir before before

Even me sef. E for don happen before but maybe e go be olden days time, no be for now. As he carry the case go court, wetin court talk?

I no know o. dem go still dey review the case and check everything before dem go talk anything. You know as court dey do their thing.

Mazi, this Sanusi story never end o. come see wetin dem write for this paper; say El Rufai don give am political appointment for Kaduna state

Which political appointment again in this kind situation; El Rufai no understand say fire dey mountain for Sanusi head and en dey come with yeye political appointment

As say na political appointment na Sanusi problem now. Which position e give am?

I know? Na all this Kaduna state things e go give am; e no go pass that one.

Why en give am that position? Abi na pity position?

Na pity position now, what else? If not he for don give am the position since; anyway something is better than nothing. Sanusi go manage that one use am rub the place wey dey pain am

You sure say Sanusi go even collect that position? Sanusi wey be proud man

If I hear say en no collect am. He get choice? Man wey dem don humiliate finish

Kai, but the disgrace is too much. Na so life be? Say person go dey on top one moment and the next moment na disrespect and disgrace en go dey chop

My brother, na only God go help us.

Na so, speaking of God. Lagos commissioner of environment don talk say God go send Lagos rainfall for two hundred and forty days straight

Hmmm, that one na good and bad news because dey flood wey go dey that state enh

I think am too. Any small rain for Lagos dey cause serious flood

Sanwo Olu dey arrange the state so maybe en go arrange the drainage make flood no dey; if not e go too bad

E go bad, na swim people go dey swim go work

Make me ma come dey go work

Me sef. Later.