Egbon and Mazi

Pidgin News (37): Serious Wahala dey Egbon Chest

Share

Mazi, I no go lie you enh; all these corona virus talk and wahala don tire me as I dey so

No be only you Egbon, anywhere wey person go now na only corona virus wahala be the talk. even as I go mass this morning nobody dey touch anybody o; even reverend father no dey shake anybody

Hmmm. Which time all these wahala go end? news don talk say the amount of people wey get corona virus for the world now don reach one hundred thousand

Chai. Nna enh, that is not good news

At all but we wey no get am go still dey thank God. Na the only thing wey we fit do be that

And no be say the corona virus no get cure; e get if not ministry of health no go talk say that Italian man wey get the corona virus don dey better, dem even talk say dem go soon discharge am

Really? Aaah, na good news be that now; make dem do discharge am so that he go go en country quick quick before the thing go come back again and another wahala go come start.

Honestly, as I see the news na so I talk for my mind. Federal Government don even release six hundred and twenty million to battle corona virus

That one better oo because that money go buy medicine and dem go take am build proper quarantine wey dem go use hold anybody wey get the corona virus. The money go even do sef?

That one matter? If e no do dem go release another one now and I know say dem go release because this one na matter of life and death. Corona virus no know senator or normal country man, e go catch whoever e wan catch

Yes o. Corona virus is no respecter of persons

Exactly. You hear the nonsense wey your minister of transport talk?

Wetin en talk?

He talk say na because of corona virus outbreak na en make dem never complete the lagos-ibadan rail road

Mtshw. Abeg leave that mumu, en dey find excuse since and en don see am. Na everybody wey dey on that project get corona virus?

Nna enh, if you ask me who I go ask? Even dey china wey get the virus pass every other country still dey work and we wey na only one person dem diagnose na en make say a whole rail road project go stop because of am

Mtshw, you no go leave this matter for mathias. I no wan talk anything wey go vex me this afternoon; I already get things for chest

Egbon, make you take am easy o. na the person wey dey alive fit get problem; no allow any problem stress you too much o

Hmm, I don hear. Abeg make I come dey go house

House? You no go work today?

Hmmm, my brother ever since this corona virus come enh; I no dey chop outside again o. I dey chop for house now

Oh I see, that one better. Okay no problem, till tomorrow

Till tomorrow.