Egbon and Mazi

Pidgin News (36): Wetin Concern Doctors with Karate

Share
Mazi, you sabi fight karate?

Na wa o Egbon, which kind question be this? No be only karate na kantaray

So simple question don turn to problem for you to answer now

Wetin concine man of my age with karate. If I tell you say I sabi fight am, e no go surprise you?

How e go surprise me? I know the kind thing wey you don do with your life as a young boy? But I sabi fight karate sha

You. Egbon, you wey siddon so sabi do karate?

They call me Ching Chung

Ha ha. No be only Ching Chung… na Chung Ching; abeg commot for road make I hear better thing

Enemy of progress; see if I do karate now now for you ehn… your life go never be the same again

Na your own life no go ever be the same again. But wetin come bring all these karate talk this mor mor?

You no watch the police women wey dey do karate for the Anambra police games?

Oh oh oh. Na that one come make you dey boast for me this morning? Mtshw, instead of you to talk about serious something na that one you come dey disturb person with.

Karate na serious thing o. No be joke

Hmmm I don hear.

Mazi, we are in trouble for this country o. Ministry of health talk say for every two thousand seven hundred and three people for this country na only one doctor dey available for all of them

What?! You mean we get one doctor to over two thousand people? I no understand, no be everyday people dey graduate from medical school for this country?

Dem dey stay? As dem dey graduate na so dem dey commot go abroad go work

Are you serious? So our doctors dey commot like that? I think say maybe one or two doctors dey move abroad; I no know say dem dey commot in great numbers

Mazi, dem dey commot in great numbers o. na almost every day I dey meet doctor wey dey write exam so that en go commot from this country

Hmmm. And you no go blame dem because I dey sure say the money wey dem dey see here no even near the one wey dem go see abroad

You don talk am. The kind money wey some countries abroad dey troway for doctors head enh, the day wey I hear am; I come dey wonder if I go enter university again to study medicine

So wetin government go do about this thing now because this thing no good at all

You dey ask me as if I be government. Na to increase the money wey dem dey pay doctors for this country now. Na the only way be that; any other method na zero.

I dey tell you. Money answereth all things. Supreme Court don dismiss Ihedioha case for court o.

Ayaah. I no dey surprise but I still pity am. After all the money wey en don spend for election and en don even settle down into position as governor before dem remove am. E no easy

But na so politics dey. Nothing is permanent, the four year tenure wey you dey find fit turn into six months tenure. Make e just go rest and prepare for another election.

Na the only thing wey e fit do be that; but in my opinion sha, if everybody start to dey carry election result go court then before you know it INEC go become useless

No be lie. Because INEC result is supposed to be trusted and respected

Anyway, na dem know. I dey go chop

Mr karate dey chop?

Mtshww