Egbon and Mazi

Pidgin News (279): Kelechi Iheanacho F*ck Up

Share

Kelechi Iheanacho

Egbon: Fake life too plenty ontop social media, na why I no fit envy anybody be that

Mazi: Yes o, na person wey wan die quick quick go dey compare him life with another man own, this life, na do your own make i do my own

Egbon: I no fit do pass myself, make dem con dey drag me like Dino Melaye, wey wan company wey dey sale motor dey drag like small generator

Mazi: Shuuu, dem drage Dino ontop wetin?

Egbon: Laugh… e get one company wey dey sale car wey talk say Dino buy motor and him no gree pay the remaining balance since 2019 

Kelechi Iheanacho

Mazi: Ehn ehn, that wan deep o, i bin think say him get money well well now, why him no con pay since

Egbon: No mind some of these Big big people, na so most of them dey behave, dey live fake life up and down, wait o, i no understand all these before before and current footballers for Naija o

Mazi: Wetin dem do you?

Kelechi Iheanacho visits Governor Yahaya Bello

Egbon: No be this Kelechi Iheanacho wey go visit Yahaya Bello after people still dey talk say Mikel Obi go visit the Kogi governor wey people bin dey suspect say him wan become presido

Mazi: My brother, Kelechi Iheanacho get right to visit anybody wey him wan visit, e no mean say e go change the thing wey go happen

Egbon: Him no suppose go visit Yahaya Bello, because that kind visit show say him support say make him contest

Mazi: Well, you get your opinion, i get my own too, you hear say federal government talk say dem still dey ontop say dem wan regulate social media

Egbon: Hiss, no mind dem jare, dem no get better priority, I no know whether na social media be the problem wey dey ground like this, bandits dey carry people, dey pai some people dem dey talk social media

Mazi: Na as i hear that news i con later hear say Adamu Garba don go collect license for him App

Woman pays 51 Million To Become Oba Elegushi’s Wife

Egbon: If him like make him go collect wetin pass license for the App, i no dey use, make him plus him family dey use am 

Mazi: Kai, some people dey greedy for this life o, con see the thing wey happen to this woman, dem say some people do wayo for her con collect 51 million naira from her 

Egbon: 51 million naira keh, that money plenty o for this kain economy like this, wetin she wan buy

Mazi: Dem say na Obodo Oyinbo she dey and she e con get wan small guy wey dey pretend like say na him be Oba Elegushi ontop internet, na so him say him wan marry the woman o

Egbon: Ohhhh, this gist dey enter my body o, so, how the guy con take collect the money?

Mazi: Dem say the guy talk say she go need send money for rituals cleansing, na so she con dey send the money give him until e con clear say she don enter one chance

Egbon: Na greed dey worry that woman, we go see later

Mazi: Ok now