Egbon and Mazi

Pidgin News (265): Dino Melaye Expose Nigerian Minister

Share

Dino Melaye Expose Nigerian Minister

Mazi: Kai, Naija my country, some of these politicians don dey add 20 and 23 o, the game don start 

Egbon: And anybody wey sabi mathematics go know say 20 plus 23 na 2023, their harvest time don dey near small small

Mazi: Hmm, i shock when i hear say Cross River governor, Ben Ayade don port go APC, say him no need umbrella again

Egbon: And you still wan make i believe say these people get conscience like this, las las, most of these governors just dey chop National cake, run go the party wey no go allow make EFCC or ICPC torchlight their matter

Dino Melaye Expose Minister Of Agriculture

Mazi: How EFCC take enter this matter now, Ayade talk say him warn support Buhari make him administration fit succeed, you dey talk say him dey run from EFCC, how?

Egbon: No be this country we gather dey when Oshiomole webi before before Oga for APC talk say dem go forgive the sin of anybody wey join APC, do the calculation yourself now

Mazi: No be say i no remember the time when Oshiomole talk that thing, but, we no need to read meaning to the thing wey Ayade do, we suppose follow the thing wey him talk

Egbon: Commot that side jare, na one by one god go dey expose them, con see as Dino Melaye expose Minister of Agriculture, con check am

Mazi: Dino Melaye expose minister of Agriculture kwa, wetin him talk say the Ministry do?

Boko Haram Leader, Shekau Commits Suicide

Egbon: Dino Melaye talk say dem carry contract give one company make dem take 30 million naira build Mosque

Mazi: 30 million naira Mosque kwa, ontop wetin, that money big o, i even think say no be Ministry of Agric suppose build that kind thing

Egbon: I wonder o, i no know when Ministry of Agric turn buiding company o

Mazi: Hmmm, Odikwa serious o, wait, i read one tory wey talk say Boko Haram leader, Shekau don pai himself fro inside sambisa forest

Egbon: Laugh…., i no even know the thing wey i wan beleive again o, this man just dey die dey come back, i bin think say Naija Army talk say dem don kill am plenty time, and him still dey do video

War Between Malami, Southern Governors

Mazi: But, e look like say him don pai true true this time o, sake of say i hear say na ISWAP members face the Boko Haram people for inside Sambisa, say na small remain make dem catch Shekau, na so him con commit suicide

Egbon: Ohhhh, e go make sense if the tory true o, but, i hope say no be say ISWAP dey try to take over from Boko Haram, and na as those matter dey ground, our AGF, Abubakar Malami dey yan dust

Mazi: Malami yan dust, wetin him talk?

Egbon: Him talk say the way wey Southern governors talk say dem ban Open Grazing look wan kind, e say the thing just be like say make Northern governors talk say make Igbos no sale spare parts for North

Mazi: Ahhh, which kind talk be that wan, how him go compare cows to spare parts, the people wey dey sale spare parts dey rent shop, dem dey pay tax and dem no take their business affect other people own

Man, 72 Dismember 9 Women

Egbon: Abi now, na why I talk say him dey yan dust be that, but Ondo state governor, Akeredolu don reply him o and i gbadun the thing wey the governor talk

Mazi: Ehn ehn, e look like say this matter get tail o, wetin Akeredolu take reply Malami

Egbon: Akeredolu talk say make Malami do anything wey him wan do, say no matter the thing wey him talk, the Southern governors no go change mouth ontop say dem don ban Open Grazing

Mazi: Malami no suppose do that kind comparison self, e no follow now, make we shift enter another gist, Hmmm, Egbon, i hear say police don arrest one 72 year old man ontop say him kill like 9 women, pieces their body like meat and bury them for Mexico

Egbon: Ehn ehn, that man na junior brother to Satan o, how him take do this kind thing?

Mazi: Dem say the man even confess say true true, him kill dem, say him even dey chop their body before him bury the remaining wey dem don find for where him bury them

Egbon: Kai, people get wicked mind sha, abeg, i no fit wait hear this tory finish, e dey do my body one kain, make i con dey go

Mazi: No wahala now, take care