Egbon and Mazi

Pidgin News (26): Wife with Knife

Share

Egbon, all these stories everywhere about wife wey dey kill their husband or husband wey dey kill their wife don too much

Mazi, na wetin I dey tell my wife this morning; e don too much, every day person go dey hear such stories; I don hear wan this morning o

Even me sef, na em make me dey talk; the wan wey I hear this morning na one man wey been wan kill en wife wey police catch

En kill dey wife?

No, police carry am before en kill am.

I hear dey wan wey na woman stab her husband because en no gree make she charge her phone; say en dey shout for her head

Na wa o. Marriage na by force?

E no be by force o. if the thing dey worry you too much and you don dey see say if you no commot, you go kill person; then e better make you commot. How you go kill you wife or your husband? Person wey you don vow to love until the day you go die

My brother and some of the wife wey dey stab their husband; when dem catch dem, dem no dey feel sorry oo

How dem go feel sorry? Killer dey feel sorry? Boko haram dey feel sorry?

At all at all. Speaking of Boko haram sef, e be like say police don arrest another set of terrorists for Kaduna

Really? How many dem be?

The police or the terrorists?

Wetin concine me with how many police, I mean how many terrorists dem catch?

Na three dem catch.

Only three? Mtshw

You no go rejoice say dem even catch one?

We don pass that stage wey we go dey catch one one terrorists as if na akara we dey share; by now dem suppose know how to apprehend at least twenty of them at a time

Dat idea, na you and my wife dey gree for that one; una dey talk as if no be naija we dey. Una dey talk as if una no know this una country

But na true, even if… yes this country no dey developed but honestly we don reach to dey catch big big terrorists … no be all these small ones around wey no even get gun

Abeg make we leave this matter before I vex, your talk dey vex me sometimes

E dey vex you because I wan better for this country?

E dey vex me because sometimes you no dey dey realistic; you go just talk dey wan wey dey for your head

No be so you dey talk? no be wetin dey your head you dey talk? abi na the thing wey dey your kidney you dey talk? mtshw abeg fi mi le jare

That one no hard. You hear wetin Fashola talk? En talk say na Nollywood films dey cause money ritual and kidnapping for this country

I gree with am, you know say my wife dey watch Africa magic too much and the only thing wey I dey see for that Africa magic na blood money ritual or babalawo or kidnapping or ashewo…. E no get any good thing wey those people dey show for their film

On this case, I gree with you well well; even my wife dey watch too much before and the thing come dey make am display some nonsense behaviour wey she dey see for film. I just tell am say if she no reduce the amount of those her useless Nollywood films wey she dey watch, I go carry am go her papa house. Make she dey watch am there

In short I dey go house now go warn my wife

Warn jejely o before she go come choke you knife

I don hear. Later