Wahala For Kidnappers
Egbon: Small small i don dey see sign say Naija get still hope
Mazi: I don dey tell you since, na you no wan believe am, Naija get hope, but wait o, wetin be the sign wey you see?
Egbon: I hear say Kebbi state Governor, Atiku Bagudu don sign law say make dem kill kidnappers for the state
Mazi: Ehn ehn, that one make sense o, these kidnappers don too much
Egbon: Abi now, e never finish o, the Governor still approve law wey talk say make dem jail anybody wey rape for life
Mazi: Gbam, better Governor, i too like that law, but, i wish say Ondo state Governor don approve that kind law wey go dey kill kidnappers
Egbon: Why you talk so?
Mazi: Hmmm, my brother, e get this tory wey i see wey talk say one 20 year old lady talk say her papa don dey do plo plo with her since
Egbon: Ah, olorun Oba o, some people no get conscince at all, Baba dey sleep with him pikin, this life sha
Wahala For Kidnappers
Mazi: Na why i wish say Ondo Governor don sign that kind law, dem for put that yeye man for inside jail, make him dey there for life

Egbon: I no just understand why many people get wicked mind, the worst thing na say e still get plenty people wey dey do this kind thing o
Mazi: Naa small small Baba Godey go dey expose dem, i read am for News say wife of Ondo Governor don talk say dem go torchlight the lady matter
Egbon: E better like that o, make Justice fit prevail, make other people wey dey do that kind thing fit learn lesson
Mazi: If Justice fit dey this country, everything go dey ok
Egbon: But wait o, we no even dey hear from Chief Justice of Nigeria since that time wey dem talk say him go Dubai sake of COVID-19
Mazi: Na true o, we no even know if him too don go collect vaccine like Atiku dem
Egbon: E possible make him don go collect the thing o, na only poor man pikin dey wait make the thing reach Naija
Mazi: Na why i dey always talk say make people make sure say dem do the thing wey no go make dem carry the virus
Egbon: Naso o, i even hear say PTF don dey consider to announce Total lockdown for some states o
Mazi: You see, i hope say dem no mention Abuja among the state where dem wan do the lockdown
Egbon: My brother, na Abuja dey top the list, Lagos plus plateau con follow join
Mazi: Hmmm, total lockdown no be beans o, make people follow simple instruction dem no go do am
Egbon: Naso many people dey do con dey blame government, anyways na all man for himself
Mazi: You talk am well, i even see one video o
Egbon: You don see video again, oya Videographer tell me wetin dey inside the video
Mazi: Naa Businessman i be, anyways, naa two preachers dey inside the video o, dem dey try fight for Lagos
Egbon: Kilo fa fight keh, why dem wan fight, preaching no suppose cause fight now
Mazi: Naa the spot where dem wan take preach cause the fight o, make i con dey move, we go talk later
Egbon: Iwasu no suppose cause fight o, take care