Egbon and Mazi

Pidgin News (11): Market Your Way Out of Political Power

Share

Mazi, how you take reach here before me? No be you I see now now for market?

Egbon, which time you take see me for market?

I see you for market this morning, I dey cross road na em make me I no fit call your name

No be me

Na lie, I know wetin I see and na you with this same cloth wey you wear now sef

E be like say you see me for dream but no be market; me wey na from house I dey come so.

Na wa o. then who come be the person wey I see for market

How I go take know now? As I commot for house, na here I come straight then I collect paper the read this Saraki news so… I never even think of market this morning sef

Ehen, wetin news dey talk about Saraki this time?

Na the same thing, Nigerian Police dey deny say dem no get hand in the demolishment of en house, say dem no even know say dem dey demolish any house wey Saraki get

Hmmm, which kind lie be that; with all the teargas wey dem carry go and ammunitions dem go talk say dey no get hand for am? Who come get hand for the demolition? Abi na FCDA

I know for them. My own be say all these things wey dem dey do Saraki na good example of political witch hunting.

Exactly and while we are talking about political witches, let’s also talk about political idiots like Governor Umahi. You hear wetin that man talk? Say he is a PDP member and a hundred percent APC member also

En get sense at all?

It is obvious that he doesn’t have sense if not he no go talk say na only him fit do anti-party activities and get away with it

En talk am? Wait first, na press he tell all these?

Which kind press, na for en house he talk am when people go pay am Christmas homage visit.

This cannot fly in another country wey person go publicly confirm say en dey do anti party activities. No be anti-party activities put Oshiomole for all the wahala we yen dey now?

You no know the kind leg wey Umahi get, you dey compare am to Oshiomole.

So you wan tell me say this man big pass Oshiomole for politics

Yes, as at right now… everybody get en time, you no see the kind thing wey Saraki dey go through now?

And this Saraki na big power for politics before o

Ehen, na wetin I dey try tell you be that. You hear say dem lock Ooni of Ife for elevator dem no wan release am for thirty minutes?

Egbon, who tell you that lie lie story? No be lock dem lock am. He enter elevator and the thing no fit open

Ehen, wetin be the difference… no be still lock dem lock am

No be lock, na technical issues. Sometimes elevator dey get problem just like how door dey get problem jam.

Ooni for don fear finish

I’m telling you, he for just think say en enemies don catch am. That elevator na wicked thing o that’s why I no like am but the thing dey convenient… like aeroplane

All you lazy people wey no like to dey use staircase, you no know say exercise is good for your heart abi

You wey like to dey trek make you leave people wey no like suffer head for this life.

Na you know. I no wan hear any complain say you dey sick, your BP dey high; I go remind you of the today wey you talk say exercise na suffer head

Abeg leave that thing.

Ose. Make I come dey go

No problem