Categories: Egbon and Mazi

Pidgin News (10): Sweater In Agbada Can’t Go Wrong

Share

Nawa for you o, Egbon. How person go wear sweater inside agbada?

How my dressing take concern you, Mazi?. Abi you no dey see the cold wey dey on ground? And you wey dey talk also follow wear sweater

I know say cold dey, na em I wear sweater but your own too much now. You no fit be guy man at all at all. If you wan wear sweater, you for wear jeans or trousers; instead you come carry the sweater join agbada

Abeg just leave me as I dey so. No be your body I dey wear the combination; is it your wear?

Abeg no vex, it is not my wear. But this cold boku

Honestly but I no dey complain because I know the kind suffer wey heat period done suffer me for this town. I go dey wear the sweater dey go

Egbon, you get new year resolution?

I no get abeg, the one wey I done get from last year; I never complete am, so na carry over I dey do so. You get new year resolution?

My new year resolution na the same as every other year wey don come and go

Wetin e be?

Ego, ego and more ego

Mazi, after you is you

You done talk am finish, any new year resolution wey no get money inside no concern me at all

Na only you wan make money for this life? You suppose get other things wey you wan achieve for this life now

Enh, people wey get other achievement wey dem wan achieve make dem achieve; as for me … Ego is the way

Nothing do you Mazi, nothing do you. As you dey cry for ego… I hope say you no eventually buy shop for Enugu main market?

Hmmm Egbon, you see as God save me enh. I be wan buy shop for that market o but something come tell me make I wait and the shop wey I suppose buy for that market that time na one of the shop wey catch fire for that market

God done try for you

Honestly, if not; na cry I for take start this new year.

God forbid, we no go cry this year

But I no just understand all these fire wey dey happen left right and centre, even for obodo oyinbo; dem also get fire problem o

Ehn, e be like say I read am sef for news but the one wey oyinbo dey experience na their weather dey cause am but our own na something else; sometimes e dey do me say na conspiracy for this our country

E dey do me like that too but I just no know. You see as gunmen go kill people for one community for Kogi state and burn most of their houses

I see the news o. dem even talk say na herdsmen do the damage say the men wey dey burn their houses dey communicate in Hausa language

Wetin concern that community with herdsmen? Dem been get quarrel?

I know? Dem even kill the king of the community join

Nawa o, which kind wahala be this for this new year? You know say these herdsmen dey cause all these trouble because of Buhari,

How Buhari take enter this talk? na em tell dem make dem go kill people for Kogi state?

No be him but dem no dey get this kind liver before until Buhari win election

Abeg, no blame one man for another man’s action. I don tire to dey hear say everything na Buhari fault. If pikin sleep na Buhari fault, if pikin no wan sleep na Buhari fault… No talk that kind talk where I dey abeg

Freedom of speech, I go talk anything wey I feel say I wan talk and I repeat myself say na Buhari cause that killing

Okay now, as you dey talk… I go come dey go… Freedom to waka

Na so you go just dey waka dey go?

Dey there dey watch.