Egbon and Mazi

Egbon Jimoh (Episode 28): No Chrismas Food for Orji

Share

Press play to listen to this article

Mazi, this one wey you dey turn your newspaper upside down, the thing no gree you read am?

Egbon, I just wan make sure say the thing wey I dey read dey here true true… no be craze dey worry me

Wetin you dey read?

See, e talk say dem don sentence Orji Uzo Kalu to 12 years imprisonment

Na so I read o, na em I rush come tell you sef; it’s like this government is actually fighting corruption because this Orji Uzo Kalu na APC guy

Na APC guy now and Buhari no save am

How e go save am? The money wey e carry too much for God’s sake. Seven point one billion and that is the one that we know o

It’s more than that. Na wa, so them don finally convict person for this government; that is good, even though na small step na still step

My brother na still step o… see now, en dey beg prison warder make dem no hand cuff am

Whether dem handcuff am o or dem no handcuff am, he go still go prison no be so?

Na so. Mazi, E be like say una protest against the hate speech bill done work o; senate president don talk say dem no go pass am

How dem go pass am? They know that if they pass that bill it will come back in the future and hunt them when some of them leave power

Na true you talk and you know enh, if dem pass am before you know it hate speech bill will turn into speech bill

I’m telling you, government will say that nobody should talk without its permission. Alas, they want to listen to the people instead of their selfish wants

Did you know that it’s that Senator Agbo that is one of the perpetrators of this bill?

Wait, that Senator that slapped a woman in a shop?

Yes, if you look well you can see that the media and press were hard on him

How wouldn’t they be hard on him? He dey mad? How he go slap woman like that? He is lucky that I was not there that day even with his police I would have injured him

Honestly, so he wanted the bill in case of next time so that if he slaps another woman again people will not have the right to scold him

Just look at, anyway thank God the bill is behind us.

How this Christmas go be now?

Why you dey ask me? I suppose ask you, you no dey travel?

I no dey travel o, na here I dey gidigbam

We dey do Christmas carol for my church tomorrow, you go come?

Dem dey share food?

So, you no fit go somewhere unless dem dey share food?

Is it not you who invited me as if they will share food there, na bad thing say I wan chop?

Every time you wan chop, I never see say you reject food for this your life

I fit reject food but not for this Christmas period, you see this Christmas period? I don prepare myself for food; the food wey I go chop ehnnn… no just worry

I go worry o because Egbon, gluttony is a sin

No be for celebration time like this, in fact sef we never wash your pikin graduation o… you suppose wash am for me. Mazi. Mazi. See this man o, I never talk finish he do commot. He will come here and meet me.