Press play to listen to this article
Nna enh, na so so fraud dey everywhere o. Even rich people wey no suppose do am still dey do am
Mazi, E get anybody wey suppose do fraud?
I mean, even the rich. Like see the CEO of Air peace airline now, wetin concern am with fraud but en don do am and dem don catch am
Aah, na you dey talk this one? No be rich pepo dey do fraud pass? Na dem dey position to embezzle money pass oo; dey have access to billions of naira without question and the only thing that is supposed to stop them is self-control
Egbon, you don talk am finish. You know say this corruption thing eh.. e no be only government, even citizens both rich and poor dey participate in corruption. You buy something for someone two hundred naira and you go and tell the person that you bought it five hundred naira… no be corruption?
Na corruption ooo, na corruption for small level and na so e go dey grow until e reach our ogas at the top.
See this actor o, see wetin e talk
Wetin?
He talk say he go never marry, which kind useless talk be that? An African man go sedon talk say e go never marry and e no want children
Mazi, which one be your own now? Na en choice
Which kind useless choice be that. Doesn’t he want someone to continue his name? Look look he says that when he is lonely he drives around in his Mercedes Benz and falls asleep in it. Mtshw
Ehnnn, he wants to marry his Benz. Is it a crime?
It is a crime, in ancient Igbo land these are the type of people they will sacrifice to the gods because they are not ready to add anything to the society
So what you are saying now is that it is by force to marry and have children?
It is a duty to the land to procreate, so what did he come to this world to come and do? Drive motor up and down. Egbon, you that is talking. Will you be happy if your only son comes today and tell you that he never wants to have children?
Olorun ma je, God forbid!
I say no more. That your cousin that is a teacher, I hope he went to school very well
Wetin you mean?
Federal government has given an order that all unqualified teachers be sacked before December 31st
It is good now because I don’t know what some teachers are teaching. Some people will tell you that they went to school but they cannot spell their names. If my cousin didn’t go to school well it’s his luck. No be me cause am
Ahn ahn, Egbon I am impressed o. I thought that you will condemn that declaration because it affects your family
If I condemn it then it means me too I am corrupt now because it will show that I want what is right except when it affects me and my family
Na true you talk o. Collect handshake and na true you talk o; many people talk say dem go school but nothing is in their brain. I’m telling you. Had it been my daughter went to school and still did not know anything after all the money that I spent… somebody would have gawun right there and then.
You that is talking, I always check my children’s curriculum and ask them questions to make sure that they are learning what is promised. Abeg, I no need olodo as pikin
Speaking of olodo, this my stupid sales boy is calling me; I am sure that he has forgotten the price of something in the shop. Let me go and make sure before he sells something half price
Okay o. But Mazi you know say you suppose do something for us this christmas oo; no just travel forget person
Who tell you say I dey travel? No be money dem dey use travel?
You Mazi, if you no travel den Christmas no dey be that
Okay now, we’ll see. Later
Alright.