Egbon and Mazi

Egbon Jimoh (Episode 25): Trek For The Bill

Share

Press play to listen to this article

Egbon, wetin be this? Why you dey do your hand like deaf and dumb? You no fit talk again?

As government say make we no talk again nkor

The hate speech bill never pass now

Ehn, e never pass but e go pass

Don’t say that o. Do you know the implication of that bill? You know the kind thing wey this bill go cause? I dey go join the people wey dey protest today

You! Mazi! You wan go protest?

Ahn ahn, hot yam dey for my mouth as I talk am? While you are here making jokes and doing like deaf and dumb, I am going to join protesters to do something about stopping the bill

How you go talk say na joke I dey make? No be say I dey mock the situation, I just tire for this country; if say this bill pass what next? Another bill to tell us exactly what to say?

See enh Egbon, I no fit talk this bill with you because for your mind the bill don pass but for my own mind the bill never pass and something can still be done about it. If Nigeria don tire you, you know say you fit relocate go Canada where you go dey trek well since you still no wan buy car because you like to dey trek

See me see iron handle. Wetin concern hate speech bill with car wey I never buy? I have not bought a car because I am trying to help the environment and not add to the carbon emissions that is causing global warming.

Ha ha. Wetin you talk now now. Global gini?

Global warming Mazi. You can laugh very well but global warming is real

So you dey here dey trek up and down because of global gini wey never come but to go protest against bill wey dey happen now now be problem

Mazi, why you just dey put words for my mouth today? I tell you say I no wan protest? In fact make we leave this topic… just leave am

You hear say na Turkey dey fund and supply Boko Haram?

Nna enh, I hear o but you know ehn. I’m not surprised; I have always known that Boko Haram has always had strong sponsorship from somewhere

But dem talk say the closure of boarders go limit the amount of things wey dem dey collect from that Turkey

Mtshw, boarder closure. So if dem tell you say government for this country dey close boarders, you go believe say dem go close the whole boarders for this country. The whole boarders kpatakpata. You wey talk say this country done tire you, you go believe say your government na honest government

See enh, Mazi you just dey tasi me today left right and center, dey give me Gbas! Gbos! Anything wey I talk na problem. Abi your wife quarrel you before you commot house this morning?

My wife no quarrel me, na you just no know wetin you dey talk. you no understand life

Abeg no insult me. How you go talk say I no understand life? Me. Egbon Jimoh… you know wetin Egbon mean? Elder. Na me you dey insult like this o

No change am for me oo. No be me leave my house come wey people dey, dey do deaf and dumb. Na you do that one.

In fact, make you sit down with your hate speech bill since na only you understand life

No be me get the bill o… Egbon… Egbon… na vex be that? People no like to hear truth for this country. Abeg dey go jare. Make I finish my poster go join protest.